Monday, April 29, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Na south-east governors form ESN as Obi tok?

Na south-east governors form ESN as Obi tok?
October 27
19:23 2022

Peter Obi, di presidential candidate of di Labour Party (LP), claim sey na di govnors for south-east form di Eastern Security Network (ESN).

Di presidential candidate make di claim on Monday, October 15, 2022, for one event wey di Arewa Joint Committee for Kaduna organise.

For di video, one pesin wey attend di event ask Obi sey “why north suppose trust you, since I dey hear news, I neva hear sey you open your mouth tok sey di sit at home wey dem dey do evri Monday for south-east no good?”

“Why north suppose trust you, wen, even di campaign council wey you form wey neva tey, for Sokoto and oda states for north, all di chairman na Igbo pipu?

Advertisement

“Why north suppose trust you wen I neva hear, maybe you don tok am before, but I neva hear you say wetin IPOB and di Eastern Security Network (ESN) dey do no good?” na so di pesin ask.

To ansa am, Obi sey im no fit tok sey wetin ESN dey do no good sake of sey na di govment of di eastern states chuk hand inside. 

“E bi like say you no dey follow my campaign. Na di govment of di eastern states create di Eastern Security Network. Di govnors naim form di security team, how I go tok sey wetin dem dey do no good? I don chuk mouth for di sit-at-home mata and e get one place wey dem even call my name. Evritin wey I dey tok, go confam…”

Advertisement

But na true sey di eastern govnors form ESN?

WETIN WE CHECK

TheCable check see sey na Nnamdi Kanu, leader of di Indigenous People of Biafra (IPOB),  form di Eastern Security Network in December 2020.

IPOB, wey Kanu create since 2012, don dey tok sey dem want dia own kontri wey go get all di pipu for south-east sake of sey Nigeria no dey treat dem beta. 

Advertisement

On December 13, 2020, Kanu come announce di launch of di ESN. Im say di main work na to protect di south-east from terrorists and oda criminals.

Before dis tin hapun, some tori wey tok sey some suspected armed Fulani herdsmen bin dey enta pipu farm for di area bin dey internet.

Meanwhile, for di announcement wey Kanu make, e tok sey di security wey im form be like Amotekun wey dey southwest and Miyetti-Allah for di north.

Im come tok sey as di south-east govnors no fit protect di Igbo pipu na why need bin dey to create di security group. 

Advertisement

If you remember, for 2021, di south-east govnors bin come form dia own security group wey dem bin call Ebube Agu, “to fight insecurity for di area”.

Dave Umahi, Ebonyi govnor, wey bin tok on behalf of di oda governors sey na as all di states no come safe again na why dem create di security group.

Advertisement

“For di meeting, all of us gree sey we go chuk hand to create security vigilante for di south-east wey go be Ebube Agu. Di meeting gree sey di vigilante, wey get headquarters for Enugu, go coordinate all di security activities for south-east,” na so Umahi tok.

FINAL TOK

Advertisement

Obi claim wey sey na di eastern govnors form ESN no correct. Na IPOB create di group. Di LP presidential candidate mistake Eastern Security Network wit Ebube Agu.

Advertisement

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.