Monday, April 29, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Aregbesola dey dance because Oyetola lose for court?

Aregbesola dey dance because Oyetola lose for court?
October 10
20:02 2022

One video wey Rauf Aregbesola, minister of interior and former govnor of Osun state, dey dance don comot for internet.

As dem share di video for Twitter, dem claim sey di minister bin dey dance because body dey sweet am as court comot Gboyega Oyetola, as di govnorship candidate of di All Progressives Congress (APC) for di election wey just pass for di state.

One Twitter user, @IfedolapoOsun, bin share di video on Friday, September 30, di same day wey di federal high court for Abuja cancel di nomination of Gboyega Oyetola and im deputy, Benedict Alabi, as APC govnorship candidates.

Di video get more dan 23,400 views, 879 likes and 352 retweets.

Advertisement

Advertisement

Dem post di video come write “Na Aregbesola bi dis today afta court don comot Gboyega Oyetola as candidate”.

Di Twitter account where dem share di video come get di foto of Ademola Adeleke as im profile picture. Na so di tin come make some Twitter users confuse, dem think sey na Ademola Adeleke, the governor-elect of Osun bin share am.

WETIN HAPUN BEFORE

Na Emeka Nwite, bi di judge wey bin make di decision for suit: FHC/ABJ/CS/468/2022 wey di Peoples Democratic Party (PDP) bin file.

Advertisement

For di suit, Mai Mala Buni, former acting chairman of di APC, and four oda pipu bin tanda as defendants.

For di mata wey Nwite bin solve, im tok sey di nomination of Oyetola and im deputy no correct and e no folo di law because Buni, di pesin wey bin submit dia names give Independent National Electoral Commission (INEC), no folo wetin section 183 of di constitution and section 82(3) of di electoral act 2022 tok.

WETIN WE CHECK

As TheCable cari eye check di video wella, e show sey one Facebook user, Ajiboye Maroof Akinlabidem bin post am before on Monday, September 26 come write: “Minister of Interior Ogbeni RAUF AREGBESOLA dey celebrate di 62nd birthday of im wife Ìyáàfin Sherifat Aregbesola”.

Advertisement

TheCable come folo Kikiowo Ileowo, di technical assistant to Rauf Aregbesola, tok and im sey, “notin jam dat video with wetin court tok for Oyetola head”, sey na when dem bin dey celebrate Aregbesola wife birthday naim dem record am.

FINAL TOK

Advertisement

Di dance video wey dem tok sey body dey sweet Aregbesola sake of sey court comot Oyetola as govnorship candidate no correct. Di video bin first comot on Monday, September 23, while di decision wey court bin make na on Friday, September 28.

Advertisement

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.