Friday, April 26, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Borno big reach UK and Sweden as Osinbajo claim?

Borno big reach UK and Sweden as Osinbajo claim?
September 12
08:06 2022

Vice-President Yemi Osinbajo tok sey Borno big reach di United Kingdom(UK) and Sweden or di UK and Denmark.

Laolu Akande, Osinbajo chief informate officer, tok for statement sey di vice-president bin folo some students from di Harvard Business School students wey visit am for di Presidential Villa on Sunday, August 28, tok.

As im dey tok wit di students wey come visit Africa, Osinbajo tok sey before di international community go really understand di kain economic and security challenges wey dey worry Nigeria, e go beta make dem first sabi as di kontri big reach.

“Di first tin bi sey, need dey to appreciate di size of di kontri, e go help to understand wetin di main issues bi. For example, Borno big reach di whole UK plus Sweden or Denmark,” na so di law professor tok.

Advertisement

“So, anytime kasala burst for Nigeria, e fit bi for one small village, and many people for Abuja and Lagos fit come hear am for social media, na so di size of di kontri bi.

“Anytime dem dey tok about di economy, dem go come compare us wit small small African kontris, but 10 states for Nigeria get GDP wey big pass those oda kontris, no bi small market.”

But Borno big pass di whole UK and Sweden combine or di UK and Denmark?

Advertisement

Di tori bin comot for some oda media houses.

WETIN WE CHECK

TheCable check di size of Borno, di northeastern state wey dem create in February 1976 come divide am in 1991 create Yobe.

Advertisement

Borno, ontop all di security yawa wey dey hapun for dia get “Home of Peace” as im oda name, come get Yobe as neighbour for di west. E folo share border wit di Republic of Niger by di north, Lake Chad (and di Republic of Chad) by di  northeast, and Cameroon by di east.

Di official website of di Borno govment tok sey di whole state na about 61,435sqkm, which mean sey na di second biggest state for Nigeria after Niger.

Based on di informate wey comot in 2020 by di National Bureau of Statistics, di National Population Commission show sey all di pipu wey dey live for di state as at 2019 bin reach 5.7m.

UNITED KINGDOM

Advertisement

Di United Kingdom include di entire Island of Great Britain, wey contain EnglandWales, and Scotland—combine wit all di northern side of di Island of Ireland.

In 2021, informate from di World Bank show sey di size of di United Kingdom reach 241,930 km². 

Advertisement

UK Office of National Statistics, di biggest independent producer of ogbonge informate, bin tok sey all di pipu wey dey live for di kontri reach 67m.

SWEDEN

Advertisement

You fit find Sweden for di Scandinavian Peninsula for northern Europe. Na Stockholm bi di capital since 1523. Sweden get di biggest part of di Scandinavian Peninsula, wey im dey share wit Norway.

Even as di kontri don di near 1,000 years wit one main form of govment, di size bin dey always change until 1809. 2021 informate from di World Bank show sey di current size of Sweden na 407,310 km² and na 10.4m pipu dey live there.

Advertisement

DENMARK

Denmark dey occupy di peninsula of Jutland wey dey reach north from di centre of di continental western Europe. Jutland get more dan two-thirds of all di land for di kontri.

As of 2021, informate from di World Bank show sey all di land for Denmark reach 40,000 km² and na 5.8m pipu dey live for di kontri.

Na true sey Borno, wey no be small state, big pass Denmark and na almost di same amount of pipu dey live for di two places but e no near Sweden and di UK for size and population.

TheCable check see sey di land size, combine wit di population of only di UK, big pass Borno by far, talk more of to  add Sweden or Denmark.

Borno United Kingdom  Sweden Denmark United Kingdom Sweden United Kingdom + Denmark
Landmass (km²) 61,435 241,930  407,310  40,000  649,240  281,930
Population 5,751,590 67,081,000 10,415,811 5,856,733 77,496,811 72,937,733

FINAL TOK

Di claim Vice-President Osinbajo make wey sey Borno big reach UK and Sweden combine or di UK and Denmark no correct at all, di gap too wide.

 

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.