Saturday, April 20, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

CBN don stop to give ‘Form A’ for outside kontri students?

CBN don stop to give ‘Form A’ for outside kontri students?
July 01
14:05 2022

Reports for social media claim sey wen year finish, di Central Bank of Nigeria (CBN), go stop to give Form A, di tin wey dey help Nigerians wey dey outside kontri pay school fees.

Nigerians wey dey abroad dey get dollars through di ‘Form A’ for official price rather dan for black market wey dey always cost pass. 

Di tori don dey worry plenti Nigerians for social media sake of say from January 2023, dia outside kontri school fees go add, according to di news.

Advertisement

Adewale Adetona tok for Twitter say, “I just read say from December 2022, CBN dey cancel Form A. Nigerians wey wan go school outside kontri go need buy dollars from black market.  Evrytin just dey wowo.” Di post get 179 retweets, 22 quote tweets, and 368 likes.

Di claim also comot for Twitter and Facebook wit one picture wey dem tok say na from Manchester Metropolitan University.

Di title wey follow di post tok say, “Central Bank don stop to give discount for di Form A moni from 31st December 2022”. 

Manchester Metropolitan University don ansa

Advertisement

TheCable follow di management of Manchester Metropolitan University tok, to confam weda na dem tok di claim.

“We understand sey CBN wan put back di moni wey dem bin reduce before from di Form A, na why we come help our students so dat dem no go enta wahala,” na so di spokesperson tok.

Advertisement

Wetin we check

Osita Nwanisobi, director of di corporate communications department for CBN, sey the advise wey Manchester Metropolitan University give dia students no get head.

Advertisement

Nwanisobi sey, “CBN no tok dat kyn tin.”

He advise parents and students sey make dem no folo any talk wey say make dem pay dia school sharp sharp through Flywire before December 31, 2022.

Advertisement

Final tok

CBN neva make any official statement wey sey dem go stop to dey provide Form A. Di claim no true.

 

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.