Thursday, April 25, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

CHECK AM: Lawan don comot for APC join PDP?

CHECK AM: Lawan don comot for APC join PDP?
June 22
19:11 2022

On June 17, one tori tok say Senate President Ahmad Lawan don comot from All Progressives Congress (APC). 

Some tweets bin claim say di senate president don comot di ruling APC go join Peoples Democratic Party (PDP).

Mustapha Kehinde, di pesin wey tweet di post say,” Ahmad Lawan leave APC go PDP because im still wan dey NASS, no be because im wan help im people. E suppose show you say na only money dey dia mind.”

Advertisement

Di tweet get at least 1,448 retweets and 4,508 likes.

One ogbonge Twitter handle wey dey normally post entertainment gist, @GoldMyneTV, follow carry di tori wey say Lawan comot for APC. Di account get pass50,000 followers.

Advertisement

Wetin hapun before

Abdullahi Adamu, di national chairman for APC bin talk say Lawan na di consensus presidential candidate of di party.

He come later contest for di primary election, but na three people beat am. Lawan carry fourth as he gather  152 votes.

Di senate president lose to Bola Tinubu, former govnor for Lagos, who bin get 1,271 votes.

Advertisement

Wetin we check

Wen di news bin dey all ova Twitter, TheCable check see say no beta news site carry di tori wey say di senate president don leave im party.

On Saturday, Ola Awoniyi, Lawan special adviser ontop media mata, share statement wey say di news no correct.

For June 14plenary, di senate president tok say two Kebbi senators don comot for di party.

Advertisement

Yahaya Abdullahi, senator wey dey represent Kebbi North, and Adamu Aliero, senator wey come from Kebbi Central, bin send letters wey tok say dem don comot APC go PDP.

Awoniyi tok say, “Na di video clip wey di senate president dey read Senator Aliero letter na im pipu go touch make e forbe like say na Lawan leave party.”

Advertisement

He come tok say di original video wey Lawan dey read Aliero letter na 3 minutes 30 seconds. But pipu wey wan cause wahala cut am go 26 seconds.

Bad belle pipu dey use di incomplete video deceive di public.

Advertisement

Final Tok

Di tori wey yarn say Senate President Ahmad Lawan don leave APC go PDP na fake news.

Advertisement

 

 

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.