Friday, April 19, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Sanusi don tok di koko why Obi, Tinubu, Atiku wan be presido?

Sanusi don tok di koko why Obi, Tinubu, Atiku wan be presido?
June 21
16:23 2022

One tori wey dey tok wetin dey di mind of di three presidential candidates for 2023 presidential elections don comot for social media.

Di tori tok say nobody for inside di candidates dey contest for money. Pipu yarn say na Sanusi Lamido Sanusi, former govnor for  central bank of Nigeria (CBN), write am.

Di first part of di post say, “One funny tin be say none of dis 3 pipu dey find money for dis president title.”

Di tori follow tok say Atiku Abubakar, presidential candidate for Peoples Democratic Party (PDP) don chop di country “well well”. Di tori tok say Atiku just wan make dem call am “president” by faya by force. 

Advertisement

E come tok say Bola Tinubu, presidential candidate for diAll Progressives Congress (APC), just wan become president because e don dey hungry am since im enter politics. Di tori say, “Di main tin be say im just wan show us pepper wit corruption.”

Ontop Peter Obi, di presidential candidate for Labour Party, di post say di former govnor of Anambra na man wey notin dey enter im eye. Obi just wan save Nigeria from di big wahala wey dey come, di post tok again say na why im wan be president be dat.

Since June 19 wey di post comot, plenty pipu don share am for Twitter, Facebook and oda social media platforms.

Advertisement

CeleSylv Updates, one Facebook page wey get 70,000 followers share am on June 19. Di post get more dan 3,000 shares, 1,800 likes and 1,400 comments.

One Twitter user, Fame Kid, post di tweet at for 2:29pm dat same day and e come get pass 2,000 likes and 1,301 retweets.

Max Vayshia, anoda user wey post di tori, get pass 1, 300 likes, 873 retweets and 57 comments.

Advertisement

Di comments show say plenti social media users believe di story sotey dem even praise di pesin wey write am.

 

 

Wetin we check

As TheCable check, we see say no beta media platform post di tori wey pipu claim say na di former CBN govnor write.

We con askSanusi weda na him write am, he say no. “No be me write dat tori, na fake news,” na so Sanusi tell TheCable.

Final Tok

Di post wey dey tok about di real reason why Atiku, Tinubu and Obi wan be president no be true. No be Sanusi Lamido Sanusi write am.

 

 

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.