Friday, April 19, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Christ Embassy: No bi us write di viral statement wey dey praise Tinubu

Christ Embassy: No bi us write di viral statement wey dey praise Tinubu
May 28
07:37 2023

Loveworld Inc., di main kompani wey get Christ Embassy International, don comot hand for di viral statement wey dey praise Bola Tinubu, di president-elect.

Pipu tok sey di statement wey dey evriwhere for social media comot from Chris Oyakhilome, oga kpatakpata of Loveworld Inc., and Christ Embassy.

Dem tok sey Oyakhilome describe Tinubu as di man wey God favour from di house of Pharoah. According to di statement, di foma Lagos govnor wey Nigerians don too badmouth naim go come transform di kontri.

“Some of us bin support VP Osinbajo during di contest inside APC and I bin write against BAT and I tok sey time don reach for new man,” na so one part of di statement tok.

Advertisement

“Dem set trap for am. For my life, I neva see any man wey pipu don badmouth pass am but e dey jump pass evri trap wey dem set. For di 8 years wey im help Buhari win, na so so insult dey folo am. Na only angel fit survive di tins wey dat man suffer.

“All di powers wey dey dis Naija no gree for am, but di man still survive dia wicked plan. Dis man na from di house of Pharaoh. Im sabi di system and e don chop from am. Im sabi where all di beta tins for the kontri dey. I dey pray sey e sabi wetin e mean to get life wey nobody go forget am. Di man don too suffer.

“Dis man no bi fool. Im get sense pass plenti of all im opponents join. Di only tin wey remain na for im to write im name inside history book and na by to get di ordinary man for mind. Im don dey find am wella, no bi today. Im no fit do am alone but e fit show di road. Make we support am.”

Advertisement

Di claims folo comot for Twitter.

Advertisement

Advertisement

LOVEWORLD: PASTOR CHRIS NO WRITE DAT STATEMENT

Advertisement

Di department wey dey in charge of informate for Loveworld comot hand for di statement. Dem tell TheCable sey di viral statement no comot from dem or Christ Embassy.

Loveworld com add sey di claims don dey internet since March, even as dem don tok taya sey no bi di church release am.

“Fake news. E no get head. Dem no get video to prove am, no audio, e just comot from air. No bi from Pastor Chris,” na so di statement wey dem send give TheCable tok.

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.