Thursday, April 18, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Di foto wey show plenti crowd na from Osun PDP rally?

Di foto wey show plenti crowd na from Osun PDP rally?
July 26
13:44 2022

One foto wey show plenti pipu wey dem claim sey na from di Peoples Democratic Party (PDP) rally for Osun state dey evriwhere for social media.

On Saturday, July 16, PDP bin hold rally for Osun sake of di governorship election.

Abban Atiku, one Twitter user with di handle @abbalala3, share di foto come write, “Osun State no be your mate”.

For di foto, no be small crowd tanda wit trees and moto wey folo dey inside di crowd. Di picture get pass 3, 900 likes, 500 retweets, and 552 comments.

Advertisement

Advertisement

As we check im Twitter sharp sharp, we see say di social media user na ogbonge PDP supporter.

Pipu claim sey di foto wey dey evriwhere na sake of sey PDP last rally dey successful.

Some Twitter users wey just follow the foto as dem see am, come dey hail di plenti pipu wey dem think say na from di PDP rally.

“I dey happy if na Osun because I like PDP ten times pass APC wey dey tiff. If LP candidate no fit get am, abeg make PDP dancing senator get am. E go sweet Obidients belle for Adeleke,” na so one comment from one Twitter user tok.

Advertisement

“Free ticket to carry eye see Davido and oda musicians. Why people no go gather? Di dancing senator go show pipu new dance style. I be LP man but if I dey Osun tomorrow, I go make sure say I enjoy well well,” na so anoda Twitter pesin tok.

Dem also share di post for Facebook.

Wetin we check

Advertisement

TheCable carry di foto check for Labnol, one computer tool wey dey check di real place where picture come from.

We see sey dem snap di foto for Ilorin, Kwara. No be Osun as pipu tok. We still check wella come see sey dem snap am for di Eid-el Kabir prayer for Kwara state, and dem first post am on July 9.

Advertisement

Kwara state government post am for dem ogbonge Twitter account, come write: “No be small worshippers comot for Ilorin, di Kwara state capital, on Saturday to do dem Eid-el Kabir prayer. Govnor @RealAARahman dey set di ground so dat pipu go fit calm down, na why im dey tok beta with all di ogas wey come from di oda political party . #EidMubarak.”

TheCable still check see sey anoda Twitter user post different pictures from di Eid-el Kabir prayer wey just finish for Ilorin. Na im mean sey dat picture no comot from Osun as pipu dey claim.

Advertisement

Final tok

Di foto wey pipu claim sey na from PDP rally no be true na from Ilorin for Kwara state.

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.