Friday, April 19, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Di moni wey Kano dey owe between 2011-2015 increase by 1000%

Di moni wey Kano dey owe between 2011-2015 increase by 1000%
December 28
11:58 2022

Rabiu Kwankwaso, di former govnor of Kano and presidential candidate of di New Nigeria Peoples Party (NNPP), claim sey im no boro any moni during im eight year tenure.

Kwankwaso make di claim on November 19 for “The Candidates” one presidential town hall series wey Kadaria Ahmed, one journalist and media business woman, host.

“Rabiu Kwankwaso no boro one Naira from any bank or anybody for dis kontri and even for abroad,” na so im tok.

“Na me bi one govnor wey neva boro, in fact, I no like anything wey go join me wit boro moni. No bi only dat one, for 1999, wen dem give me govnor, no bi small gbese dem leave for me but I pay am for four years.

Advertisement

“I no win di election for 2003. After eight years, I still come back come jam anoda gbese and na so I still pay in four years. As I leave Kano I no owe one naira.”

Im still come make di same claim on November 13 wen im attend di presidential town hall meeting wey Channels Television organise.

As im dey ansa how im go take run di kontri wey gbese no go increase, Kwankwaso still tok sey dat time wey im be Kano govnor, im govment no boro any moni.

Advertisement

“For Kano, our budget bin always dey balance because we dey cari eye kip for wetin dey come for road, wetin dey important and wetin we suppose do. I no bi one of dose pipu wey dey quick rush to boro moni do wok,” na so im tok.

“Moni yakpa for dis kontri. Anybodi wey sey moni no dey no sabi or im just dey do wayo. Enof moni dey wey fit take care of evribodi for di kontri.

“We don do am before for Kano from 1999 to 2003. We bi jam plenti gbese and we come pay dem. After eight years, wen I go back as govnor, I jam gbese wey reach hundreds of millions of US dollars and we settle dem before I comot for 2015.

“I dey tok of moni wey dem dey boro from bank or pesin. For di eight years wey I be govnor, we no boro.”

Advertisement

In 2021, in an interview with Arise TV, Kwankwaso accused Abdullahi Ganduje of plunging Kano state into huge debt. Once again, he claimed that during the eight years he spent in office as governor, he never borrowed one naira.

NA TRUE SEY KANO NO BORO ANY MONI DI TIME WEY KWANKWASO BI GOVNOR?

Between 1999 and 2003, na Rabiu Kwankwaso bi di govnor of Kano.

Im contest again for 2003 but im no win. Dem come give am appointment as minister of defence, from 2003- 2007.

Advertisement

In 2011, im come win Kano govnorship election.

Di Debt Management Office (DMO) no get any informate for dia website wey fit gree wit di claim wey Kwankwaso make.

Advertisement

EXTERNAL GBESE REDUCE BY 9.89 PER CENT BETWEEN 2011 & 2015

For govment mata, e get two kind of moni wey dem fit owe – external and domestic.

Advertisement

External gbese na wen dem dey owe pipu wey no dey from di kontri while domestic gbese na di one wey dem dey owe people inside di kontri.

According to informate from di DMO, in 2011, Kano bin get external gbese of $63.94 million wen Kwankwaso enta office for im second tenure.

Advertisement

 

Wen im comot for 2015, di moni wey Kano bin dey owe drop go $57.61 million, na reduction of 9.89 per cent bi dat.

DOMESTIC GBESE INCREASE PASS 1000 PER CENT

Official informate from di DMO show sey between 2011 and 2015, during Kwankwaso second term for office, domestic gbese for Kano increased by 1008 per cent.

For 2011 when dem re-elect am, N5.87 billion bin already tanda as di domestic moni wey dem bin dey owe. For 2015, wen im comot for office, di gbese reach N65 billion, na 1008 per cent increase be dat.

No bi evritime wey domestic gbese increase wey bi sey na because of boro. Sometimes na because interest rate dey increase or difference for foreign exchange. 

But TheCable check see sey noting bin jam foreign exchange wit di plenti gbese wey Kano bin get. Even 4 years increase for interest rate no fit increase di moni to dat kain amount. 

In fact, di average exchange rate dat time na N155 to $1 in 2011, and N197 to $1 in 2015.

ABDULLAHI GANDUJE CONFESS SEY DI STATE BIN BORO MONI

Before dem fight, Ganduje, Kwankwaso deputy govnor wey become govnor in 2015, tok sey im bin dey normal for im former oga to leave ova 300 billion naira gbese for Kano – amount wey plenti pass wetin DMO tok.

“I no sure sey Kwankwaso do bad tin as im leave all dis plenti moni because I bin sabi evritin wey bin dey hapun,” na so Ganduje tok.

Im attack all di pipu wey use mouth finish Kwankwaso for di gbese mata, sey di borowing bin make sense because of di drop for oil revenue dat time.  

One tori bin tok sey Ganduje sey make Kano pipu praise im former oga, sey e bin no easy to transform di state even as di moni wey dem bin dey owe bin plenti. 

“I bin sabi evritin, our bodi bin dey sweet us us because we tink sey evritin go smooth based on di oil money. Before you know, na so di tin just drop,” na wetin di 2015 report sey Ganduje tok.

“Anyway, normally govment dey leave gbese for di next pipu wey dey enta office. All dose pipu wey dey shout up and down, na dem go do wetin bad pass by di time dem enta office. Dem suppose praise my govnor Kwankwaso for di development wey im make sure sey Kano experience.”

According to anoda news tori, for 2015, local contractors for di state bin ask anti-corruption agencies to check Kwankwaso for one N200 billion wey dem claim sey im bin dey owe for Kano before im run go senate.

For 2015, Auduwa Maitangaran, di state chairman of Nigeria’s chamber of indigenous contractors sey more dan 50 contractors for Kano bin go prison and more than 100 members bin dey admission for hospital sake of di moni wey Kwankwaso govment bin dey owe dem. 

“More dan 40 of our members don die because of sickness wey dem bin come get as di former govnor no relese dia moni,” na so im tok.

Di contractor tok sey “Kwankwaso bin only pay 30 per cent of all di projects wey im do in four years”, remaining 70 per cent wey im no pay. Im sey even as di govment tenure finish, dem no pay 50 per cent of di indigenous contractors.

“Alhaji Idi Bilya, our member, bin die of heart attack because dem no pay am im moni and anoda member Alhaji Ibrahim Carpenter wey Kano state government dey hold im N50m no fit comot N5,000 now. Na wickedness bi dat,” na so di 2015 report sey di chairman of di contractors tok.

Muhammad Garba, former commissioner of information, bin also accuse Kwankwaso of borrowing N4.1bn pensioners’ funds to build housing estates.

Daily Trust sey Garba bin tok sey: “Kwankwaso boro N4.1bn pensioners’ funds to build Bandirawo and Amana housing estates make pensioners enjoy di houses wey for comot.

“But as im come see sey di houses bin too dey expensive for dem, im reduce di price come 50 per cent. But even as im do am, dem bin still fit no buy am.”

FINAL TOK

Di claim wey Kwankwaso make wey sey im govmemt no boro moni no correct. Informate show sey di state gbese increase by 1008 per cent. Also, Ganduje and contractors for di state confess sey di domestic gbese wey bin increase na sake of boro.

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.