Wednesday, April 24, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Di video wey show flood dey carry white jeep na from Nigeria?

Di video wey show flood dey carry white jeep na from Nigeria?
October 26
17:08 2022

Dakore Egbuson-Akande, Nollywood actress, post some videos for her Instagram account wey dey show some places wey flood don affect wella for Niger Delta. 

On Sunday, di actress post video wey get part 1-6, di part 1 show some kain tins wey fit make pesin catch cold. No bi small struggle one white jeep bin get to drive for road wey get plenti water and potopoto. 

As e bi so, Dakore Instagram account get more dan 1.4 million followers.

As di car dey try move, e hook for inside di water. Di ogbonge wind and plenti water troway di car for deep water.

Advertisement

Na so pipu wey dey stand watch come dey shout as water and potopoto swallow di car wey bin get passengers. 

“Dia is fire on di mountain!!! Di kain tins wey dey dis video dey comot from many part of Nigeria and di Niger Delta dis season and e dey make cold dey catch me. My heart dey cry for dis kontri. My pipu, which way? Which time our “leaders” go cari our mata for dia head?”, na so Egbuson-Akande write.

Advertisement

Di video of di white jeep, togeda with di oda 5 videos wey dey show di flood wey dey affect Nigeria gather pass 6,779 likes as at di time wey dis report comot. Di actress bin no allow pipu comment for di post.

Na so TheCable come cari di video check weda e correct or not and na wetin we find be dis:

WETIN WE CHECK

We cari plenti screenshots of di first video wey get di white motor do reverse image search for Labnol. Labnol na beta tool for internet wey dey check wia picture first comot from and which oda pictures resemble di one wey you wan check.

Advertisement

E show sey di video don dey internet since 2017 and pipu dey always use am as example for different flood in di world. One example na di tropical Cyclone Dineo, one of di worst tropical cyclones wey don ever hapun for di south-west Indian Ocean and di southern hemisphere. 

TheCable check how sey dem bin originally record di video for Chaman, Pakistan, wen heavy rain bin dey worry di kontri in January 2017. 

For di longer version of di video, e come be like sey di pipu wey bin dey stand look come try to rescue di motor and di passengers wey bin dey inside.

FINAL TOK: Di video don dey internet since 2017 and na from Pakistan e comot, no bi Nigeria as di Nollywood actress claim.

Advertisement

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.