Friday, April 19, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Kola Abiola tok sey security council neva hold meeting since 1999. Na true?

Kola Abiola tok sey security council neva hold meeting since 1999. Na true?
November 18
08:01 2022

Kola Abiola, presidential candidate of di Peoples Redemption Party (PRP), claim sey di National Security Council (NSC) neva sidan for meeting since 1999. 

Abiola make dis claim for di presidential town hall meeting wey Arise Television wit di Centre for Democracy and Development (CDD) organise for Abuja. 

Im bi one of di four presidential candidates wey folo attend di town hall meeting wey hapun on Sunday.

Peter Obi, presidential candidate of di Labour Party (LP), Rabiu Kwankwaso, presidential candidate of di New Nigeria Peoples Party (NNPP) and Ifeanyi Okowa, vice-presidential candidate of di Peoples Democratic Party (PDP) wey tanda for Atiku Abubakar, di party presidential candidate, folo attend. 

Advertisement

Na so all of dem tok wetin dem go do for di security and economy of di kontri if dem become presido. 

Reuben Abati, di pesin wey dey handle di program come ask dem wetin dem for do, if to sey dem be commander-in-chief, wen bandits bin attack di Kaduna-Abuja train in March 2022. 

To answer di question, na so Abiola tok sey di national security council neva hold meeting since 1999. 

Advertisement

“That painful attack na just one of di plenti security wahala wey we don dey face for many years. Na one of di problems wey show sey bigger kasala dey. We suppose go back go check our security and di way we organise our defence,” na so Abiola tok.

“As time dey go, dem tok sey dem wan check am to see wetin no dey well and how dem fit make am beta but na di main problem be dat? I no sure but since 1999, di national security council neva do meeting for one day and na di pipu wey dey control di security for Nigeria be dat. Dem neva do meeting since 1999.”

WETIN WE CHECK

TheCable cari eye look Section 153, subsection 25 of di 1999 constitution wey get all di officials wey dey inside di NSC.

Advertisement

According to di section: “Di national security council suppose get “(a) di President wey go bi di chairman;  (b) the vice-president wey go bi di deputy chairman;  (c) di chief of defence staff;  (d) di minister of di govment of di federation wey go dey look di internal affairs.  (e) di minister of di govment of di federation wey go dey in charge of defence;  (f) di minister of di govment of di federation wey go dey look foreign affairs;  (g) di national security adviser  (h) di inspector-general of police; and  (i) any oda pesin wey di president feel sey fit do di work”

Subsection 26 come explain sey di council suppose advise di president on any mata wey consign public security “including ontop mata inside any agency wey di law create so dat security go tight for di kontri.”

TheCable bin report sey on October 14, President Muhammadu Buhari bin organise meeting of di national security council for di presidential villa in Abuja.

Di tori bin tok sey noted Yemi Osinbajo, vice-president, Boss Mustapha, secretary to di government of di federation (SGF), Babagana Monguno, national security adviser (NSA), and Ibrahim Gambari, chief of staff to di president, bin folo dey for di meeting.

Advertisement

Oda ministers wey bin folo attend di meeting na Bashir Magashi, minister of defence, Rauf Aregbesola, minister of interior, and Maigari Dingyadi, di minister of police affairs. All di service chiefs and ogas of oda security agencies bin folo attend.

Even on October 31, 2022, one tori bin comot wey sey di presido bin organise one emergency security council meeting.

Advertisement

Dem bin hold di meeting to see how dem fit make di security for di kontri beta.

FINAL TOK

Advertisement

Di claim wey Abiola tok sey NSC neva do meeting since 1999 no correct. Even on October 31, 2022, di presido bin organise meeting wit di council.

 

Advertisement

 

 

 

 

 

 

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.