Saturday, April 27, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Masturbation dey make hair comot for man head?

Masturbation dey make hair comot for man head?
September 05
17:51 2022

One post for social media claim sey masturbation na one of di main tins wey dey make hair comot  for man head.

Eric @amerix, di pesin wey first post am for Twitter, claim sey na frequent ejaculation dey shift all di hair wey dey man head go back.

“One of di main reasons why men hair dey comot na because of masturbation. Frequent ejaculation dey make all di vitamins wey dey make hair grow comot for body.  If you see any man wey im hair dey shift go back, remind am make im try dey hold imsef,” na so di tweet tok.

Di post get more dan 1, 400 retweets and 8, 800 likes.

For Facebook, different accounts share di post plenti times. One example na Emem Nelson wey claim sey im bi doctor. More dan 8, 000 pipu dey follow am.

Jay Ade, anoda user for Facebook, repost di claim ontop Medriod Elite City, one public group for Facebook wey get over 9, 000 followers.

Advertisement

WETIN WE CHECK

Di Merriam-Webster dictionary define masturbation as di action wey pesin dey touch imsef especially around di private part till most times wey im reach oragsm.

According to di explanation wey di dictionary give, no bi only to touch body be masturbation, sometimes e fit be wen pesin dey think sexual tins or wen anoday pesin dey touch your body without sex.

TheCable come folo some medical experts tok, to confam weda anytin for science dey support if masturbation or frequent ejaculation dey make men hair comot.

Advertisement

Best Ordinioha, professor of public health and community medicine, tok sey di claim no get head, sey notin dey join masturbation with hair loss for medicine.

Im sey di pesin wey make di post for Twitter just dey find pipu wey go folo am tok.

Advertisement

“E be like di pesin just dey post tins wey go make pipu fear. Dis kain tins go dey make pipu dey look men wey their hair dey comot anyhow. Wen pipu see dem, e go be like na wetin dem dey always do be dat,” na so di professor of medicine tok.

“For health science, na increased testosterone dey make hair shift go back, testosterone na di hormone for man body. But as I tok before, nothing for science show sey frequent ejaculation dey cause baldness.”

Advertisement

“Pipu wey get high testosterone body go wan dey have sex evritime but e get some kain tins wey dey reduce am: stress fit make man no fit give woman belle, and sex no go dey im mind again. E be like di pesin wey post dat tin overstretch am.”

SOME TINS WEY DEY MAKE MEN HAIR COMOT

Advertisement

Francis Agbaraolorunpo, medical expert for di University of Lagos, sey some tins like, how your family genetics dey, medical conditions and too much use of chemicals fit cause make hair comot for man head, but masturbation no folo join.

“One of di main tins wey dey cause hair loss na genetics, meaning sey dem fit born you like dat. Anoda tin fit be sey di pesin get am from im parents,” na so im tok.

“Some pipu hair fit fall comot if dem get alopecia or anoda serious medical condition like cancer. For dat kain case, even woman fit get hair loss

“If you see man wey im hair shift go back, most of di times, dat gene dey im family, e fit be sey na gene wey bin no dey show before, but e fit come comot for di pesin body wem im dey expose to some kain conditions for im enviroment.”

However, di medical expert tok am again sey masturbation no di cause hair loss or di way man dey look, im sey dat one na psychological issue.

Im come tok sey sometimes wen pesin no too dey confident, im fit dey masturbate, sey e fit cause “infertility issues”.

“Any man wey dey masturbate wella fit get low sperm count wen im wan jam woman.”

FINAL TOK

Di claim wey sey masturbation na one of di main tins wey dey cause men hair dey comot no correct. According to science, notin jam masturbation wit hair for head.

 

 

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.