Thursday, April 25, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Na true sey CBN don introduce N5000 and N2000 notes?

Na true sey CBN don introduce N5000 and N2000 notes?
November 19
08:05 2022

One video wey dey show N5,000 and N2,000 notes don dey evriwhere for internet.

For di video wey dem share for Twitter on October 27, one woman bin dey show bundles of N5,000 and N2,000 notes.

Di woman claim sey na one “mad man” bin deposit di moni for di bank branch wey she dey work.

“I hope sey na joke be dis,” na so dem write on top di video. E get more dan 33k views, 1,028 likes and 367 retweets.

Advertisement

Dem folo share di video for Instagram and plenti accounts for Facebook, where plenti Nigerians wey no know wetin dey hapun shock.

On October 26, Godwin Emefiele, govnor of di Central Bank of Nigeria (CBN), bin tok sey di bank go change di design of some naira notes.

Emefiele tok di new design, wey go dey ontop N200, N500 and N1000 go comot around middle of December 2022. 

Di CBN govnor bin tok sey dem bin dey change di naira design because of some challenges wey dey affect di way di kontri dey manage currency. Im tok sey if to sey dem no change di design, yawa for gas for di CBN and di whole kontri.

Advertisement

WETIN WE CHECK

TheCable cari di video check for Invid, one internet tool wey dey check di koko for any video, to check wetin dey inside. Keyframe analysis of di video show sey e don dey Facebook and YouTube since 2020. 

As we check di video well, we see sey one side of wetin dem claim sey na N5000 note get di foto of one man wey dey wear cap, and for di oda notes, na foto of three women side by side. 

Keyword search for Google show sey di CBN bin announce in August 2012 sey dem go introduce N5,000 notes

Advertisement

Sanusi Lamido, di CBN govnor dat time, bin sey na di faces of three ogbonge Nigerian female activists go dey ontop di new notes. Im sey na Margaret Ekpo, late politician and social mobiliser; Hajia Gambo Sawaba, late politician and activist, and Funmilayo Kuti, late politician and women’s rights activist.

Lamido explain sey di N5000 note go improve di quality of banknotes, go get beta feature for pipu wey dey blind, and reduce di cost of production, distribution and disposal of banknotes.

Advertisement

But plenti pipu no gree for di mata. The Institute of Chartered Accountants of Nigeria (ICAN) tok sey if di N5000 note comot, naira go weak pass as e dey.

Na so di Nigerian government come suspend di introduction of di N5000 note. Dem sey make di “CBN go gather more informate for di mata.”

Advertisement

Also, di CBN ontop dia Twitter handle on May 31, 2020, tell Nigerians sey make dem no cari believe di fake pictures and videos wey dey internet dat time. 

All di videos and pictures of N2,000:00 and N5,000:00 banknotes no correct. Make di members of di public no believe wetin dem dey see and make dem report anybodi wey get di notes to law enforcement agencies,” na so di CBN tweet.

Advertisement

Pipu dey share di old video for social media because dia bodi dey shake ontop di new naira notes wey CBN tok say go comot around middle of December 2022.

 

Meanwhile, di CBN bin sey na N200, N500, and N1000, dem go redesign. Di bank no tok anyting about N2000 or N5000 notes.  

FINAL TOK

Di video wey dey evriwhere for internet wey dey claim sey federal govment dey introduce N2,000 and N5,000 notes no correct. Di misleading video don dey internet since 2020.

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.