Saturday, April 20, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Na true sey TB Joshua wife promise Peter Obi 8 million votes?

Na true sey TB Joshua wife promise Peter Obi 8 million votes?
August 04
17:42 2022

Some posts wey dey evriwhere for social media claim sey wife of di late TB Joshua promise Peter Obi, presidential candidate of di Labour Party (LP), eight million votes.

For one Youtube video wey News Express Nigeria TV post on July 17, dem tok sey Evelyn Joshua, wife of di late prophet, don stand gidigba wit Obi as election dey come for 2023.

Di video get “2023 Presidency: Evelyn TB Joshua don promise Peter Obi 8 million votes” as di headline and more dan 530 pipu don watch am. 

Advertisement

Some oda Facebook pages folo cari di tori.

For Nolly Roll, one Facebook page wey get more dan 3 million followers, di post get pass 10,000 likes, 1,300 comments and 724 shares.

Advertisement

We notice sey na di same tin most of di Facebook pages wey share di post write.  Dem join di post wit picture of di late pastor, or im wife. Some pages even join di two pictures.

“I go give Peter Obi 8 million votes from my church. Normally, I no dey support any politician, but Peter Obi no be ordinary candidate. Na pesin wey go change Nigeria,” na so all di Facebook pages write.

Di post folo reach Twitter.

Advertisement

Wetin we check

TheCable try folo di Synagogue Church of All Nations (SCOAN) tok, to check weda Evelyn Joshua tok dat kain tin.

But dem no ansa any of our calls, later dia number no come dey go.

We come search dia ogbonge social media pages see sey, on July 15, dem release message for dia Facebook and Instagram.

Advertisement

Pipu bin claim sey Evelyn Joshua tok sey God tell her one candidate like dat go win di 2023 elections, na why dem release di message.

“We don notice sey plenti socia media posts claim sey pastor Evelyn Joshua tok sey God tell her one candidate like dat go win di 2023 Nigerian elections. Abeg, no be true, pastor Evelyn Joshua no tok anytin like dat. If you wan hear any true tori from SCOAN, na from Emmanuel TV or any of our confam social media pages,” na so di post tok.

Advertisement

As we check dia Facebook, we see sey dem bin post di same tin on June 20, but dem no tok anytin about di 8million votes for Obi.

Advertisement

TheCable come folo Julius Abure, national chairman of di Labour Party, tok.

Im tok sey, “plenti pipu dey support Obi for dia own way and we no get any wahala wit am.” Im sey “Change dey really hungry Nigerians.”

Advertisement

About di “8 million votes wey di church promise” as pipu claim, im sey “di synangogue church never folo Peter Obi or di parti tok in any way.”

Final tok

Di claim wey tok sey Evelyn Joshua promise di presidential candidate 8million votes no be true.

 

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.