Monday, April 29, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Senegal president-elect bin criticise France for viral video?

Senegal president-elect bin criticise France for viral video?
April 05
14:28 2024

If you don dey active for social media platforms in di last 48 hours, you fit don watch one video wey dey supposedly show as Bassirou Diomaye Faye, president-elect of Senegal, dey criticise France.

Dem share di video — wey don go viral for social media for Nigeria and some oda African countries — for TikTok, X(former Twitter), Facebook, LinkedIn, and WhatsApp.

“Time don reach make France comot leg from our neck make dis wicked oppression stop. Hundreds of years of misery, human trafficking, colonialism, and neo-colonialism don cause suffering wey no fit dey measured. Time don reach to end dis cycle of oppression,” na so di speaker tok for di video.

Many pipu wey share di video happy sey Faye, wey dey road to become di youngest elected African president, dey put leg for ground ontop France mata.

Advertisement

One X user, @von_Bismack, with ova 100,000 followers, post di video on Tuesday afternoon. Since im post di clip, e don gada 500 likes, 333 retweets, 32 comments, and ova 20,000 views. Di link don dey archive for here.

“Time don reach make France leave Africa alone”…Mr. Bassirou Diomaye Faye, di newly sworn-in president of Senegal. Dis simply show as France popularity don dey reduce for Africa,” na so di X user caption di video.

For Facebook, O’Kay Adedayo post di video with di caption: “Africa don wake. Make God protect di new Senegalese president. Nigeria dey next in 2027. No more puppet regime for anybody. Time don come to start to jump into di developed world economically.”

Advertisement

WETIN WE CHECK

TheCable check different keyframes for di viral video inside reverse image search, observe sey di clip na from di speech wey Ousmane Sonko, Senegal top opposition leader, give for one press conference for July 2021, in Dakar, Senegal.

Sonko bin give im speech for French, no be English, as e dey for di viral video.

During di press conference, di opposition leader no free for di proposed decision of di Senegalese govment to adopt one anti-terrorism law.

Advertisement

Im bin also criticise France for wetin im describe as di inability of di European kontri to allow dia former colonies thrive.

Dem live-stream di press conference for di YouTube channel of Senegal 7, one local media outlet for di French-speaking kontri. Throughout di one-hour and thirty-minute press conference, Sonko tok for French.

Im folo publish di full transcript of di press conference for im X account. Di transcript also dey for French.

TheCable also discover sey di deepfake technology wey dem use change Sonko voice for di clip give di impression sey im speak for English.

Advertisement

Furthermore, we still discover sey di viral portion of di speech wey dem attribute to di Senegalese president-elect don dey YouTube since 2023.

ANYTIN JOIN SONKO AND FAYE?

Advertisement

Sonko na di leader of Patriots of Senegal (PASTEF), di political party wey sponsor Faye for di presidential election.

Many political analysts for Senegal believe sey Faye na protégé of Sonko. Both men bin dey prison in di build-up to di presidential election but dem release dem weeks before di election.

Advertisement

Howeva, di kontri supreme court ban Sonko from contesting di election. In response, PASTEF put Faye as dia standard bearer.

FINAL TOK

Advertisement

Di speaker for di viral video wey dey criticise France no be Faye, di Senegalese president-elect, but Sonko, di leader of PASTEF. Di viral video na manipulated version of one press conference wey Sonko hold for 2021.

 

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.