Wednesday, April 24, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

To swallow semen fit make person body relax?

To swallow semen fit make person body relax?
October 03
17:55 2022

One Twitter post claim sey when pesin swallow semen, e dey help am sleep well, comot stress for body, and make am no dey overthink.

“If you swallow semen, you no go dey depressed; if you swallow semen, your mood go jolly; if you swallow semen, e go comot stress for your body; if you swallow semen, you no go overthink; if you swallow semen, you go begin dey sleep well,” na so di tweet tok.

Di post gather pass 8,700 likes and 4,300 retweets.

Dem share di post for some Facebook accounts plus one wey im name na Nurse Practitioner.

Advertisement

Semen, wey get anoda name as seminal fluid, dey comot from di male reproductive tract during sexual activities. Di thick liquid wey wan resemble white colour contain sperm cells wey fit fertilize di eggs wey dey woman body.

Semen get plenti tins inside am including vitamin C, B12, ascorbic acid, calcium, citric acid, fructose, lactic acid, magnesium, zinc, potassium, sodium, fat, and some oda proteins.

WETIN RESEARCH TOK?

Even though health experts never too do research to check weda benefits dey ontop swallowing semen, plenti tori for internet dey make di same claim.

Advertisement

Many of di tins wey dem sey swallowing semen dey do for body na because of di tins wey full inside am and how those proteins dey take help body normally.

TheCable check see sey na one study wey dem do since 2002 na im pipu dey use make all these claims. Dem been study 293 sexually active women, come check di connect between semen and dia mood. Dem discover sey di women wey get direct exposure to semen been no too dey depressed like oda women.

But di study bin only focus on semen wey dey enter vagina instead of for mouth, and e tok sey di results na “di first test so di answers no too correct”.

Anoda study wey pipu dey folo quote na one wey comot for 2015. E tok sey semen contain melatonin wey bi di  natural chemical for body wey dey help pesin sleep. Di study only focus on how melatonin dey affect man fertility. E no tok anything about how di melatonin for semen dey affect pesin wey swallow am.

Advertisement

WETIN EXPERTS TOK?

TheCable come folo some medical experts tok to confam if science support di claim.

Advertisement

Best Ordinioha, professor of public health and community medicine, sey notin jam pesin wey swallow semen wit all those benefits wey pipu claim.

“If any advantage even dey, maybe na from di main sex and no be because pesin swallow am. Na true say semen get some kain nutrients but di nutrients na to help di sperm wey dey go fertilize di egg. Di nutrients no bi di kain one wey go come dey help body. Na just small calories we dey tok about here,” na so im tok.

Advertisement

“You know sey some pipu no dey feel comfortable to dey swallow semen during sex so e fit be sey di pesin wey make di claim just dey use style encourage dem. Sometimes make pipu dey carry eye check wetin dey di mind of di pesin wey make di claim.”

Ayo Ajeigbe, clinical psychologist, sey these claims no correct because beta research never comot to support am.

Advertisement

“Most of these claims go just pick one or two things come relate am to each other. Just because sey sperm contain melatonin no mean sey e dey help pesin wey swallow am,” na so im tok.

“If to sey research dey support am, e for don be solution for pipu wey get some kain problems. In fact, dem for even use am do medicine make pipu swallow.”

Di psychologist come sey most of di studies wey dey support di claim no test plenti pipu and e no dey enough to come up with that kain conclusion. Also, di semen wey dey comot from man body too small to get all di kain nutrients wey go fit benefit the body well well.

FINAL TOK

Di claim wey sey to swallow semen dey help cure depression, make your mood jolly, reduce stress and overthinking, and to help with sleep no dey confam. Beta research neva comot to support di claims.

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.