Friday, April 19, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Viral video wey pipu dey shout ontop Kwara govnor na from 2018

Viral video wey pipu dey shout ontop Kwara govnor na from 2018
August 17
13:37 2022

One video wey pipu dey vex use shout for Abdulrahman Abdulrazaq, govnor of Kwara state, don comot for internet.

Di pipu vex sotey dem call di govnor “Ole”, wetin Yoruba pipu dey call tiff. Na shout dem use comot am from one event.

Pipu wey share di video claim sey di kasala never tey. Dem sey e hapun wen di govnor and some members of di ruling All Progressives Congress (APC) visit Kwara state polytechnic for rally.

Advertisement

Na for Peter Obi Support Group, one Facebook page, dem share di video. Di post get pass 2,600 views.

Anoda page, Nigeria Youth Movement, folo share di video come write: “Pipu wey comot from APC go PDP wey dey sing ‘Sai Buky Bukola Saraki’ don pursue Kwara state govnor.”

Even YouTube, WhatsApp and TikTok carry di video.

Advertisement

E-vibez TV, one YouTube page wey share di video, tok sey Abdulrazaq bin dey try campaign for 2023 re-election. Pipu don watch dat video pass 7,900 times.

Wetin we check

TheCable cari di video check for InVID, di beta internet tool show sey di first time wey di video comot for YouTube na 2018.

Advertisement

Di video first comot for Kwara Gist, one YouTube page, on December 26, 2018. Dem write sey: “Area scata for Ilorin for di 53rd annual apolitical gathering of Ilorin Emirate Progressive Descendant Union (IEPDU), wen pipu wey dey support di Senate President, Dr. Bukola Saraki sscata di event.”

On August 9, di Kwara state govment shake body ontop di video for statement for dia confam Facebook page.

Bashir Adigun, special adviser for political communication to di govnor, sign di statement wey tok sey: “Fake video ontop govnor AbdulRazaq head: Rememba wen Kwara dey pass thru kasala.”

Adigun tok sey di video comot on December 26, 2018, wen agbero and pipu wey dey support Bukola Saraki, former senate president, close eye scata di event wey IEDPU organise.

Advertisement

Adigun tok sey di video na wen Abdulrazaq bin still dey contest for govnor and im attend di event as special guest of im village. 

Im tok sey notin bin hapun for di Kwara polytechnic on August 7, 2022, wey for make di govnor go show for di place.

Advertisement

“All those pipu wey post dat video evriwhere, dia body just dey scratch dem to show sey pipu dey vex for di govnor,” na so Adigun tok.

Final tok

Advertisement

Di video wey dey evriwhere wey pipu dey vex and shout ontop Kwara govnor no get head. Dat video na since 2018, no be new one. 

Advertisement

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.