Saturday, April 27, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Ambode don go Labour Party?

Ambode don go Labour Party?
July 15
22:50 2022

Plenti posts for social media claim sey Akinwunmi Ambode, former govnor of Lagos state, don go Labour Party (LP).

According to di post, di former govnor wan contest for di parti as govenor for di 2023 election.

 

Advertisement

Advertisement

 

On July 5, Leadership Scorecard, folo carry di tori, wit one statement wey dem tok sey Ambode tok, sey make di youths get dia PVC for this election wey dey come for 2023.

“Di youths dey come. Power dey dia hands. Go collect your permanent voters card (PVC). Your time don come,” na wetin di post tok be that.

On July 7, as di tori wey tok sey Ambode dey go LP come dey hot, e enter top 10 trend for Twitter.

Advertisement

Wetin we check

Social media search show sey di post wey pipu claim sey Ambode dey tell youths make dem get dia PVC don dey im Twitter page since February 1, 2022.

Advertisement

We come check im ogbonge Facebook, Twitter and Instagram accounts but notin tok sey im leave di All Progressive Congress (APC) go Labour Party (LP).

Beta news platform for carry dat kain political mata but dem no carry am.

Advertisement

TheCable try folo Ambode executive assistant, and Julius Abure, di national chairman of di Labour Party, tok, but dem no ansa dia call or message. We go update dis tori if dem ansa.

Premium Times folo Ifagbemi Awamaridi, Lagos state chairman of the Labour Party, tok. He tok say Ambode neva go LP.

Advertisement

“Ambode still dey wit di ruling All Progressive Congress (APC) parti. Na ogbonge APC member wey go make sure say di parti win for state and federal level,” na so he tok.

Final tok

Di Claim wey dey evriwhere wey sey Ambode comot go Labour Party no be true.

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.