Saturday, April 27, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Bello el-Rufai do mistake. Hadiza Balarabe no be Naija first elected female deputy govnor

Bello el-Rufai do mistake. Hadiza Balarabe no be Naija first elected female deputy govnor
March 23
14:38 2024

Bello el-Rufai, lawmaker wey dey represent Kaduna north federal constituency for di house of representatives, claim sey Hadiza Balarabe na Naija first elected female deputy govnor.

Di lawmaker tok for podcast wey Seun Okinbaloye, di broadcast journalist, host.

Di podcast, with 16.3k subscribers, get 94,760 views, 602 comments and 2.9k likes.

Bello na di son of Nasir el-Rufai, former govnor of Kaduna state.

Advertisement

In 2018, Nasir el-Rufai bin select Balarabe as im running mate for di 2019 govnorship election for di state.

Im tok sey di reason why im pick Balarabe na because Barnabas Bantex, im deputy dat time, bin inform am sey im go contest senator.

Before dem select her as el-Rufai running mate, Balarabe na di executive secretary of di Kaduna State Primary Health Care Development Agency.

Advertisement

WETIN WE CHECK

As im dey tok wetin im papa achieve for Kaduna, di lawmaker tok sey im papa, through Balarabe, renovate all di 255 primary healthcare centres for di state.

“Fortunately, one of di tins wey my papa do with im deputy govnor, Dr Hadiza (Balarabe), wey be di first female elected deputy govnor for Nigeria, na to renovate di 255 healthcare primary centres for Kaduna,” na so di lawmaker to

However, TheCable check see sey since civilian rule come back for 1999, Nigeria don get some elected female deputy govnors for different states before Balarabe.

Advertisement

DI ELECTED FEMALE DEPUTY GOVNORS

Lagos na di first state wey elect female deputy govnor. In 1992, during one short civilian rule, na Micheal Otedola dem elect as govnor of Lagos state under di National Republic Convention (NRC) with Sinatu Ojikutu as im running mate.

Ojikutu dey that position till November 1993 wen di military collect power.

In 1999, Nigeria enta civilian rule. Bola Tinubu bin win di Lagos govnorship election under di Alliance for Democracy (AD) party with Kofoworola Akerele-Bucknor as im running mate.

Advertisement

From that time, di likes of Adebisi Sosan, Adejoke Orelope-Adefulire, and Oluranti Adebule get di position of elected female deputy govnors of Lagos between 2007 to 2019.

Ayo Fayose bin appoint Abiodun Olujimi as di first female deputy govnor of Ekiti from September 2005 to 2006. Funmilayo Olayinka come be deputy for Kayode Fayemi from 2010 to 2013 before she die while Modupe Adelabu become deputy govnor for May 2013.

Advertisement

In Ogun state, Salimat Badru bin serve as deputy govnor from 2003-2011, and Yetunde Onanuga chop deputy govnor of di state from 2015 to 2019.

Advertisement

In Osun, Olusola Obada folo be deputy govnor from 2003 to 2010 during di administration of Olagunsoye Oyinlola, while Titilayo Laoye-Tomori become deputy govnor of di state from 2010 to 2018.

Pauline Tallen become di deputy govnor of Plateau state for 2007, and di first woman to be deputy govnor for northern Nigeria while Ipalibo Banigo deputise Nyesom Wike for Rivers from 2015 to 2023.

Advertisement

Cecilia Ezeilo bin serve as deputy govnor to Ifeanyi Ugwuanyi afta im win di state govnorship election for 2015.

Dem elect Noimot Salako-Oyedele togeda with Dapo Abiodun for Ogun state for 2019, di same year wey Balarabe enta office as di first female deputy govnor of Kaduna.

In 2022, dem choose Balarabe as Uba Sani running mate. In March 2023, dem relect her deputy govnor.

FINAL TOK

Di claim wey Bello el-Rufai make sey Balarabe na di first elected female deputy govnor fo Nigeria no incorrect.

Na Sinatu Ojikutu bi Naija first female elected deputy govnor.



Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.