Advertisement

No, dis viral video no show army revenge for Okuama

One social media post claim sey officers of di Nigerian Army do revenge attack for Okuama community, Delta, afta 16 soldiers die for di state.

Na one viral video naim dem dey use as evidence of di alleged revenge.

On March 14, youths kill some army personnel —including one lieutenant colonel, two majors, one captain, and 12 soldiers — as dem go assignment for Okuama.

Di death of di soldiers cause serious anger for di kontri — togeda wit different allegations. One example of di allegation tok sey soldiers burn down di community as revenge.

ADVERTISEMENT
Advertisement

“Okuama for Delta state dey burn finish dis morning sake of Nigerian Soldiers wey dey vex. Nigerian Army don declare war for dat region,” @EmekaGift100, one X user tweet as im share di video in question.

The X user tok sey im bi human rights activist and “image maker” for di Indigenous People of Biafra (IPOB), di outlawed separatist group.

Di tweet, wey comot on March 18, don gada over 97,200 views, 706 retweets, 581 likes, and 181 comments.

Advertisement

For di 54-second video, you fit see as fire dey burn different boats ontop water while thick smoke dey rise enta air.

“Dis kain tin good?” na so one man wey dey tok inside video just dey tok for Pidgin as explosions dey sound from di fire.

“Enof fuel dey here dey catch. Na wetin we dey face every year be dis but pipu no know, dem think sey we dey enjoy. We no dey happy o.”

According to @EmekaGift100, na di army set up di fire to burn “helpless children, women, old” alive.

Advertisement

Somto Okonokwo, anoda X user, make similar claim, and im add sey di military dey unfairly target southerners while dem dey protect Nigerians for north.

For di last count, di post don gada 133, 600 views, 1,400 retweets, 1,200 likes, 256 comments, and 86 bookmarks.

WETIN WE CHECK

TheCable check screenshots of di video for reverse image search see sey di same clip bin dey uploaded to TikTok for late January — nearly two months before di killing of army personnel for Delta.

Advertisement

Di time wen dem first post am, dem attribute di video to one fire outbreak for Nembe Waterside, one jetty for Port Harcourt, Rivers state capital.

“Anoda fire outbreak for Nembe waterside near creek road for Port Harcourt,” na so di video caption tok.

Advertisement

Di video folo get di same background tok and surrounding features as di same one wey dem share evriwhere for Twitter afta dem kill army personnel for Delta.

Extensive keyword search comot news reports wey show sey di video na from one January 2024 fire incident wey destroy goods and property for Rivers state.

Advertisement

FINAL TOK

Di video no show di burning of Okuama community for Delta state.

Advertisement

Add a comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

error: Content is protected from copying.