Wednesday, May 8, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Na true say Obasanjo support Peter Obi, tok say na ‘man wey pure’?

Na true say Obasanjo support Peter Obi, tok say na ‘man wey pure’?
June 20
11:40 2022

For June 14, one Twitter account wey get di name of former president Olusegun Obasanjo, tok say Peter Obi, di presidential candidate for Labour Party, na pesin wey pure.

Di Twitter account wey dey always post tori about di former president bin get 5000 followers wen di Obi tweet comot. Now, di account don almost get 10,000 followers.

Di post wey get Obasanjo and Obi picture tok say, “Peter Obi no be saint, but among politicians for Nigeria today, na man wey pure.”

Advertisement

Di tweet don get pass 33,000 likes, 8,000 retweets and 900 comments.

Some pipo for social media wey dey look di post believe say na Obasanjo post am. Dem tok say na better tin im do.

Advertisement

Festus Agene, wey follow dem join body, tok say, “na beta approval from Baba Obj be dis.”

Dave Saint sef tok say, “to dey pure na  somtin wey today politicians no get, but PO [Peter Obi] get am full ground. Bad belle pipu, wey dey carry bad politicians give Nigerians to vote for 2023, sake of say dem wan chop, God no go gree. Thanks, Olusegun Obasanjo for di kind words to PO.”

Advertisement

Wetin we check

Advertisement

Internet search show say no beta media house carry di tori wey di former president tok dat kain tin.

Wen TheCable contact Kehinde Akinyemi, wey dey do tok tok for Obasanjo, im tok say no be true, say di former president no tok dat kain tin.

Advertisement

He con add join say Obasanjo no get Twitter account, say im no even get any social media account sef.

 

Final tok

Di social media post wey tok say Obasanjo give Peter Obi hand of support no be true. Na fake account post am.

 

Dis tori comot in partnership wit Report for the World, global service program wey dey support local public interest journalism.

 

 

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.