Sunday, April 28, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

No be Osimhen dey train wit chain and tyre for di viral video

No be Osimhen dey train wit chain and tyre for di viral video
February 05
08:52 2024

Victor Osimhen na of di ogbonge players wey Nigeria get for di current Africa Cup of Nations (AFCON) for Ivory Coast. Even though na only one goal im don score inside four matches, di striker get strong hand for Super Eagles’ attack. 

Na im dey inspire di team and im hand come show wella for di second round match against Cameroon wey im help Eagles chop 2-0 win over di Indomitable Lions.

Di 25-year-old show di Cameroonian defence line pepper, as im just dey folo ball evriwhere, dey help di Super Eagles on both sides of di pitch. Di 2023 African footballer of di year still provide assist for di opening goal wey Ademola Lookman score.

Afta im performance for di match, some Nigerians for social media begin dey share one video wey “Osimhen” dey allegedly train like sey tomorrow no dey.

Advertisement

For di viral video, di pesin, wey get body like Osimhen, dey do physical training with tyres, chains and cement wey dem mold.

“You wan sabi why Osimhen dey show im fellow footballers power ontop field when trouble wan start? See im physical training,” Na so Nkirukamma, one X user, write as caption wey folo di video.

As e be so, di post don gada pass 291,000 views togeda with thousands of likes and retweets for X (former Twitter).

Advertisement

Di video don also comot for different accounts and dem don share am plenti times for WhatsApp.

Advertisement

WETIN WE CHECK

Advertisement

TheCable track di video go where e first comot from and e show sey na Ebube David, one online content creator, naim post am.

David — wey be di pesin for di video wey dey train with chain and tear-tear tyre — get more dan 190,000 followers for TikTok and im dey popular because e dey always dress like Osimhen.

Im upload di video on December 13, 2023, with di caption: “Victor Osimhen work hard to achieve im dream, so you sef fit.”

@osimhenjnr_9 Victor Osimhen worked hard to achieve his dream, you can too. #victorosimhen #osimhen🇳🇬 ♬ original sound – ebube david

FINAL TOK

Di pesin for di viral video no be Victor Osimhen, na Ebube David. Di claim wey tok sey na Osimhen dey di video no correct.

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.