Saturday, May 4, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

No, dis video no show Cyclone Biparjoy

No, dis video no show Cyclone Biparjoy
July 18
10:26 2023

One video for social media don get wrong caption sey na Cyclone Biparjoy.

Di Twitter video  wey dey show as twister dey move sharpaly ova one seascape bin dey online on June 14. Ova 79.4k pipu view dis video.

“Scary video of #CycloneBiparjoy dey move go towards Karachi. Cyclone Biparjoy dey form too fast,” na so di caption tok for di Twitter post

CYCLONE BIPARJOY

Advertisement

Tropica Cyclone Biparjoy hit di northeastern Arabian Sea, wey dey towards southern Pakistan and western India for June, with winds wey dey as high as 160 kph and surge of 195 kph.

According to di Joint Typhoon Warning Center, at landfall, di Biparjoy dey equal to strong tropical storm wey get winds of 100 kph. Di cyclone bin unleash strong wind wey scatter trees, e even scatter electric pole join.

Apart from di storm, as dem dey expect, flooding come be di most significant effect wey affect millions of pipu wen di cyclone make landfall for di West Indian and South Pakistan coasts.

Advertisement

For 2021, studies wey some researchers for di Shenzhen institute of meteorological innovation and di Chinese University of Hong Kong bin rite, show sey Asia tropica cyclones fit cause double kasala by di end of di centuri, sey di cyclones dey get power from di human-made climate crisis.

CARTOON WEY DEM PRODUCE FOR 2022, NO DEY RELATED TO CYCLONE BIPARJOY

Di keyframe analysis of di video show sey di video bin dey for one YouTube channel, Tsarovvideo, in August 2022 – ten months before di  Cyclone Biparjoy.

Advertisement

Anoda eye inside di YouTube handle show sey Tsarovvideo don post plenti cartoon videos of natural disasters and oda severe weather conditions.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey di video dey show Cyclone Biparjoy as e affect di western India and Pakistan na misyarn. Di video na wetin computa make wey don dey  internet since August 2022, 10 months before di Cyclone Biparjoy.


This content was produced with support from the Independent Media Response Fund, an initiative of the Check Global Program at Meedan to respond to global challenges through hyperlocal initiatives. The fund is supported by the Swedish International Development Cooperation Agency (Sida). 

Advertisement

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.