Saturday, April 20, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Terrorists tok for 2022 say dem go burn churches for Nigeria? No, na old video pipu dey share

Terrorists tok for 2022 say dem go burn churches for Nigeria? No, na old video pipu dey share
June 17
08:20 2022

Video wey dey show Ayuba Elkana, Zamfara state commissioner of police, wit threat letter from suspected bandits wey dey tell Christians make dem close church for three months for Zamfara don comot for social media.

Dem share di video for Facebook, Twitter plus Whatsapp.

One pesin for Facebook wey post am on June 14 caption am say, ‘Police don confam say dem collect threat letter wey tok say make all churches for Nigeria close for three months.”

Di facebook account get pass 112,000 followers. Dem don watch di video pass 165,000 times, comment don reach 750 wit 8,200 shares.

Advertisement

As we come check di comments well well, we see say di video and di caption misinform some plenti Facebook users wey bin no know.

Wetin we check

As TheCable carry eye look di video, dem see say di video don dey YouTube since 2021.

Advertisement

Dem film di video for Zamfara wen Elkana dey follow tori people tok for November 30, 2021. As e dey tok for Gusau, di state capital, Elkana confam say im receive threat letter from suspected bandits wey tok say make churches for Zamfara close for three years if dem no want wahala.

Di police commissioner tok say, “Na unidentified persons drop di letter for state police command domot.”

As e dey tok di ogbonge plan wey security pipo get make everywhere dey safe, di police oga tok say di letter actually name some churches wey dey outside Gusau wey di bad belle bandits wan attack before 2021 finish.

TheCable come reach out to Iliya Tsiga, di chairman of di Christian Association of Nigeria (CAN) for Zamfara, and im tok say di video wey dey everywhere na old one.

Advertisement

“I don see di video wey you dey tok of. Na old video from 2021. Dem just comot am again. We don solve di mata; enibodi wey dey post dat video na trouble maker wey wan cause wahala for di state,” na so Tsiga tok.

“Dem write di letter as threat to Christians for di state. Dem no call eni tribe name. Make our pipo comot mind from dat video face wetin concern dem.”

Final Tok

Di video na old one since 2021. Di claim wey dey everywhere say bandits just tok for 2022 say make all di churches for Nigeria close for 3 months no be true.

Advertisement

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.