Sunday, April 28, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

To drink okro water fit help woman born sharpaly?

To drink okro water fit help woman born sharpaly?
February 01
12:00 2024

Some posts for social media claim sey okro water dey help women cari belle sharp sharp.

Okro water, according to these posts, na okro wey dem don cut, soak inside water.

Di vegetable wey dey popular becos of di way e dey draw na popular delicacy for Africa, especially for West and Central African countries. 

Aside from food wey dem dey take cook, some social media users claim sey e follow be fertility medicine.

Advertisement

For one Facebook video, one pregnant woman show as she take prepare di medicine to help her “born easily”.

For di video, di woman cut okro inside containers wey get water, cover dem wit plastic leather, come tok sey e suppose dey fridge for 24 hours. She come comot di okro from di water, add fruits make e sweet.

“Una welldone o, I just jam dis one… and dem tell me sey e dey help women wey dey try get belle ovulate wen you drink am. Abeg, I go advise some women make dem try am,” na so anoda Facebook post tok.

Advertisement

As reply, anoda Facebook user tok sey: “Yes na natural way to increase ovulation, na very good tin for woman wey dey try born.”

Di pesin wey comment still come tok sey e dey “boost ovulation”, sey “e beta to dey take am evri morning from di beginning of di first day wey your period finish”.

Di video don gada 944 views, 59 likes, and nine comments while di second post comot for one public group wey get ova 427,000 members. Di post get 419 comments, 411 likes, and nine shares as e be so.

OVULATION AND PREGNANCY

Advertisement

Ovulation dey hapunp wen woman ovary release mature egg during di menstrual cycle.

Di egg go come travel down di fallopian tubes and di womb go start to prepare for pikin. Pregnancy dey hapun wen di sperm successfully fertilise di egg.

During pregnancy, women suppose increase some nutrients wey dem dey take before like protein, iron, folic acid, iodine, and choline. E also dey important to get enough calcium, vitamin D, potassium, and fibre.

WETIN WE CHECK ABOUT DI CLAIMS OF OKRO WATER

Advertisement

To understand wetin dey inside okro, TheCable folo Elizabeth Kembe,  professor of home economics for di College of Food Science and Human Ecology at di University of Agriculture, Makurdi, Benue, tok.

Kembe tok sey di vegetable na functional food wey contain minerals, vitamins, and antioxidants, but she sey proof no dey sey e dey affect sexual health.

Advertisement

“Vegetables get different roles wey dem dey play. Some dey good for di skin, some dey good for sleep, and digestion. But to connect okro to pesin sexual health, I neva see dat kain scientific tok,” na so she tok

“We know sey na healthy vegetable wey get nutrients wey dey help body… pesin sexual and reproductive health na anoda mata.”

Advertisement

One study wey comot for di United States National Library of Medicine show sey okro na nutrient-rich food and to add am inside pesin food dey bring many benefits including dietary fibres, carbohydrates, proteins, and high levels of minerals.

Because of wetin dey inside, di study tok sey di vegetable fit help pipu wey get diabetes. 

Advertisement

Dem no tok anyting about weda e dey help sexual and reproductive health.

Mohammed Bukar, professor of obstetrics and gynaecology for di College of Medical Sciences, University of Maiduguri, folo TheCable tok and im tok sey di claims wey tok sey okro dey improve women fertility, help dem born well, na “scientific rubbish”. 

“E get ways wey dem dey take check claims. To di best of my knowledge, dem neva study dis mata anywhere,” na so e tok.

“Na only wen dem study am and e pass through all di scientific procedures and dem don confam am for anoda place before pesin fit make dat kain statement.”

FINAL TOK

Dem never prove di claims wey tok sey okro dey boost fertility and make woman born easily. E no get any scientific evidence to support di claim. Experts advise sey make women wey dey find antenatal care folo gynaecologist tok.



Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.