Monday, April 29, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Di carbon emissions wey comot from di Canada wildfires pass di ones from di last 100 years?

Di carbon emissions wey comot from di Canada wildfires pass di ones from di last 100 years?
July 07
14:02 2023

One post for Instagram claim sey di amount of carbon wey enta di atmosphere sake of di recent wildfires for Canada pass di ones wey human beings don cause in di last 100 years. 

“You fit TRY all dat electric car, solar power, zero emissions NONSENSE from now till tomoro but na di truth go remain: By di tym Mama Nature finish wit us, WE GO SABI,” na so dem write for di post

Di post get more dan 6,500 likes for Instagram. Anoda one wey resemble am also dey Facebook.

WILDFIRE FOR CANADA

Advertisement

Since 2023 start, wildfires don dey happen for Canada, wit huge smoke wey enta some parts of di US. By di month of June, Canada cari eye see more dan 400 wildfires, wey dey burn at di same time all ova di kontri, and dem bin no fit control more dan half of di tin. 

Di fire pursue thousands of pipu wey dey live for western Canada comot from dia house. Also, e make sure sey oil and gas companies stop dia production by force.

Becos of di kain fire wey burn, di air wey dey plenti parts of di kontri, including di Great Lakes area and some northeastern parts of di US, contaminate.

Advertisement

Di US environmental protection agency bin tok sey more dan 100 million people bin dey affected by air quality alerts for areas like Philadelphia, Chicago, Atlanta, Philadelphia, Pennsylvania, Syracuse, Bethlehem, and New York. 

 CO2 FROM 2023 WILDFIRES AND DI LAST 100 YEARS

Experts no gree wit di claim wey tok sey di carbon emissions wey comot from wildfires plenti pass wetin human beings don produce in di last 100 years. In fact, dem believe sey you no fit compare dem in any way.

Advertisement

TheCable look di Keeling Curve, evriday record of di CO2 concentration wey dey for di atmosphere, by di Scripps Institution of Oceanography at di University of California. Informate wey dey di graph show sey no serious increase dey di atmospheric CO2 for 2023 so far.

TheCable still cari eye check di carbon emission graph wey di National Oceanic and Atmospheric Administration (NOAA) publish, wey dey record any sharp increase for atmospheric CO2 since 1958. Di graph no show any beta increase for CO2 wey for support di social media claim. 

Taiwo Ogundeji, PhD student, wey dey study environmental systems and climate change for di Federal University of Agriculture Abeokuta, tell TheCable sey e no make any sense to compare emissions wey comot from three months of wildfire wit di ones wey don comot in di last 100 years or post-industrial revolution.

Advertisement

“Di statement no correct,” na so im tok.

“To tok sey di amount of carbon from wildfires inside some days of one year pass di one wey don gada for 100 years no get head.

Advertisement

“Aside from industrialisation and some oda anthropogenic contributions to atmospheric carbon, make we no forget sey plenti wildfires don dey hapun in di last 100 years.”

Werner Kurz, senior research scientist for di Canadian forest service, bin tok sey di “total emissions from all human activities since 1850 don near 10,000 times more dan di emissions from di 2023 Canadian wildfires”.

Advertisement

FINAL TOK

Di claim wey tok sey di carbon wey comot in three days from di Canadian wildfires pass di one wey don dey earth for di last 100 years no correct. Informate wey scientists don drop about CO2 emission togeda with reviews by experts show sey di claim no get head. 

Advertisement

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.