MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Di viral video wey soldiers hold heavy gun wit plenti knives no bi from Niger Republic

Di viral video wey soldiers hold heavy gun wit plenti knives no bi from Niger Republic
August 06
21:21 2023

One video wey don dey waka ontop internet tok sey some soldiers wey dey show dia guns, dey flex dia muscles na army from Niger Republic.

For di TikTok video wey dey evriwhere, you fit see as soldiers wey hold big gun dey move bodi laik sey dem wan go fight war.

Dem come dey march dey sing war song, dey flex bodi with strong face. Na so pipu just dey look – e dey sweet some for bodi, odas dey fear.

On Friday, @VictorC26525018, one Twitter user, post di video come tell Nigerian citizens make dem pray for dia own army as dem dey go jam dia mates for Niger wey dey “more dan ready”.

Advertisement

“Pray for our soldiers for dis war because Niger Republic army dey more dan ready to face dia enemy. Look dis video. Say no to War. Africa fighting Africa. Na wetin Western pipu want so dat dem go fit sell dia gun. Africa why,” na so di tweet wey dem don view more dan 100 times tok.

Gbadebo Rhodes-Vivour, Lagos governorship candidate under di Labour Party (LP), folo post di same video for im Twitter account.

Even though Rhodes-Vivour no tok say di soldiers na from Niger, di politician tweet bin focus on di kasala wey dey hapun for di West African country.

Advertisement

“Unlike some pipu, na only one passport I get and my loyalty no dey for any oda kontri. Na only Nigeria I get,” na so im tok.

“To fight with pipu wey bi laik sey dem dey find as dia economy go beta togeda wit how dem go dey free from oyibo pipu hand, no go favour our govment becos pipu dey see us as kontri wey get plenti power. E fit still come affect our security.”

As of di time wen dis tori comot, Rhodes-Vivour tweet bin gada 1,103 replies, 3,217 retweets, 7,801 likes, 416 bookmarks, and dem view am 1.8m times.

 

Advertisement

Di video with di same caption still comot for plenti Facebook accounts.

Open Nigeria, one Facebook page wey claim sey na non-profit organisation get am, post di video tok sey Nigeriens no get anything to lose for di war.

Advertisement

“I hope sey Seyi Tinubu, Yusuf Bichi, Umar Ganduje, Hope Uzodimma, Festus Keyamo, Muhamadu Buhari, Femi Gbajabiamila, Tony Elumelu, Aliko Dangote, Akpabio, Orji Uzor Kalu and di children of all di supporters of di darkness go dey di battlefront against Nigeriens wey no get anything to lose for dis Imperial European war against Africa,” na so di post tok.

Di video wey dem share evriwhere na as President Bola Tinubu move bodi laik sey im wan send army go Niger Republic sake of di political katakata wey dey hapun for dia.

Tinubu, wey be chairman of di Economic Community of West African States (ECOWAS), tok sey di union bin gree sey dem go send army for di meeting wey dem hold on Sunday in Abuja.

ECOWAS bin give Niger one week from Sunday to put President Mohamed Bazoum back for power or dem go face more painful punishment.

Howeva, many kontris, including Russia, and oda pipu wey dia hand folo dey inside di mata like di ECOWAS defence chiefs don tok sey make dem use mouth settle di mata instead of to send army.

WETIN WE CHECK

TheCable cari plenti keyframes of di video check for reverse image search to sabi di first time wey di video land internet.

Di results show sey di video bin dey ontop one YouTube page on April 4 – Senegal Independence Day.

Di video wey dem title “April 4: Commandos show | Independence Day Senegal | 2023” show as soldiers dey do one small performance to celebrate di Independence. Na so citizens just dey hail dem.

Di military independence parade na di first one wey dem hold for Dakar, di kontri capital, in four years because of break from di COVID-19 pandemic.

Violent kasala between security pipu and political opposition supporters bin don dey worry di kontri one week before dem celebrate dia 63rd independence anniversary from France.

FINAL TOK

Di posts wey tok sey di soldiers wey dey di viral video na from Niger Republic no correct. Di soldiers wey dey di video na Senegalese army wey dey perform parade to celebrate di kontri independence. Also, di flags for di background na Senegalese flag colours, no bi Nigerien own.

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.