Monday, April 29, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Dis video no show sey geo-engineering dey push climate change

Dis video no show sey geo-engineering dey push climate change
July 07
14:01 2023

One Twitter post claim some pipu dey use one high-frequency active auroral research program (HAARP) to push climate change mata.

“Dem dey use #HAARP push  #climateChange mata, and human being dey pay for am. All of us suppose gada join hand to stop dis #GeoEngineering …. Make una share dis informate #Turkey #earthquake #TurkeyEarthquake,” na so dem write for di Twitter video.

Sergeant News Network, wey im user name na, @Sgtnewsnetwork, naim post di video where e gada more dan 143.5k views. Some oda Twitter users follow share di video with di same claim, and na so thousands of pipu view am.

WETIN BI HAARP?

Advertisement

Di high-frequency active auroral research program na science process wey dey study di properties and behavior of di ionosphere. Ionosphere na di part of di sky for earth wey dey jam wit space.

According to di National Aeronautics and Space Administration (NASA), one US agency wey dia main wok na to study aeronautics and space research, “di ionosphere reach like 50 to 400 miles above di earth surface, near di mouth of space. 

“Along wit di neutral upper atmosphere, di ionosphere na di line between di earth lower atmosphere — where we dey live and breathe — and space.”

Advertisement

Dem bin first build di facility where dem dey gada informate for HAARP inside di US air force, but in August 2015, dem transfer am go di University of Alaska Fairbanks. 

HAARP na di world’s most capable high-power, high-frequency transmitter for di study of di ionosphere.

DI HAARP PROGRAM DEY PUSH CLIMATE CHANGE?

According to di official HAARP website, di ansa na big no. In fact, di program no fit create any natural disaster, tok more of to make am big.

Advertisement

Di study of di ionosphere no dey change weather in any way, mostly because di “radio waves for di frequency wey dey comot from HAARP no dey enta di troposphere or di stratosphere — di two levels of atmosphere wey dey produce weather for earth”. Therefore, since dem no dey jam, e no get any way wey di process dey control di weather.

DI TWITTER VIDEO NO NEW, E DON DEY INTERNET MORE DAN 10 YEARS

TheCable cari di keyframes of di video wey dey evriwhere check for Google reverse image search, wey show sey di video don dey for YouTube since April 2013. 

But one tin bi sey, di video wey don tey wey dey show as aeroplane dey release one white tin inside di atmosphere get anoda completely different meaning from di Twitter post. 

Advertisement

For YouTube, dem write for di video sey “Aeroplane Video – Boeing 747 supertanker water bomber aerial water drop. High Altitude water drop”

Wetin dem write for di YouTube video explain sey di Boeing 747 aircraft na firefighting aeroplane wey dem dey use quench forest fire. Di plenti white tin wey bin dey comot from di plane na water and e no get anytin to do wit geoengineering as dem bin claim.

Advertisement

FINAL TOK

Di claim wey tok sey di HAARP project dey cause climate change and earthquakes no correct. Di project dey focus on di study of di ionosphere, and experts tok sey e no fit push climate change or cause any natural disaster.

Advertisement

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.