Monday, April 29, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Na Bill Gates cause diphtheria for Nigeria?

Na Bill Gates cause diphtheria for Nigeria?
July 12
14:15 2023

Warning: Dis tori get some kain foto wey fit make cold catch you.

If you be Naija pesin wey dey read news, you fit don read or hear about diphtheria for Nigeria.

Diphtheria na bacterial infection wey dey kill. Na di corynebacterium species dey cause am, and e dey affect di nose, throat, and sometimes, pesin skin.

Some of di symptoms of diphtheria na fever, runny nose, sore throat, cough, red eyes, neck swelling, and difficulty to breathe.

Advertisement

To control di infection, di Nigeria childhood immunisation schedule advise sey make children dey take three doses of pentavalent vaccine (vaccine wey get diphtheria toxoide) in dia 6th, 10th and 14th week.

Even as di federal govment don step up efforts to fight di sickness through di Nigeria Centre for Disease Control (NCDC), many pipu still dey tok sey Bill Gates, co-chair of di Bill and Melinda Gates Foundation, get hand for why di disease dey Nigeria.

In June, Gates bin visit Nigeria to discuss global health and development with different stakeholders. Im start im visit for Abuja, where im meet President Bola Tinubu, come still travel go Niger Republic before im enta Lagos to attend one youth event.

Advertisement

On July 3, after Gates go back US, di Federal Capital Territory Administration (FCTA) announce sey diphtheria don enta Abuja afta one result comot positive from some samples wey dem bin cari go check from some suspected cases inside one village near Dei-Dei area.

Sadiq Abdulrahman, di FCT director of di public health department, tok sey di four-year-old wey bin test positive kpai sake of the di disease.

Since Gates just visit Nigeria, many pipu come join di news of di disease to di visit of di philanthropist and di pesin wey start Microsoft.

TheCable find some comments for social media wey Nigerians take join di disease with Gates.

Advertisement

Advertisement

Di mata no dey surprising especially as dem don accuse Gates before sey im create di COVID pandemic so dat im go fit control people come make plenti profits.

But di journi wey cari Gates come Nigeria get any connection wit di recent diphtheria wey enta kontri?

To ansa di question, we cari eye look di tins wey don hapun before.

NO BI TODAY DIPHTHERIA ENTA NIGERIA 

E don tey wey diphtheria enta Nigeria. Abuja no bi di first place for di kontri wey di disease start.

Twelve years ago, between February and November 2011, dem bin report one diphtheria case for Kimba village inside Borno and some oda communities. Out of di 98 cases wey dem report as di disease cast, 21 pipu die. At dat time, NCDC bin tok sey dey disease spread come dey kill pipu because vaccine no reach plenti places and dem bin no quick discova di mata for hospital.

 

In December 2022, NCDC notice sey diphtheria enta Kano and Lagos states. Oda states like Katsina, Cross River, Kaduna, Osun and, FCT, wey neva tey, don follow report case.

Between December last year and June 30, di amount of diphtheria cases don reach 798 wit 80 deaths from 33 LGAs inside eight states. Abuja only get one case and one death.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey na Gates cause di most recent diphtheria case no correct.

Nigeria bin record some diphtheria cases for Borno twelve years ago, and e neva tey wey dem announce some cases for some states six months before Gates land Naija. Di claim wey dey evriwhere na anoda amebo tok wey dem don knack onto di head of di pesin wey start Microsoft.

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.