MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

No, tribunal no tok sey LP candidate Pela win Delta govnorship election

No, tribunal no tok sey LP candidate Pela win Delta govnorship election
September 07
20:32 2023

One video wey Hichief Sunny Odogwu, one Facebook user, post claim sey di tribunal tok sey Kennedy Pela, candidate of di Labour Party (LP), win di 2023 Delta guber election.

Im post di six-minute video on August 31.

“BREAKING: Court of Appeal Rule Sey Labour Party Govnorship Candidate, Ken Pela Win Di Delta State Govnorship Election,” na so dem write ontop di post wey don gada 70,000 views, 266 comments and 1,300 likes.

Advertisement

Odogwu still come ask di pipu wey don watch di video sey make dem share am give odas.

WETIN WE CHECK

E neva tey wey TheCable publish one tori wey di court of appeal for Abuja command di Delta state gubernatorial tribunal to hear di case wey Pela cari come.

Advertisement

Di Independent National Electoral Commission (INEC) bin announce sey na Sheriff Oborevwori, candidate of di Peoples Democratic Party (PDP), win di March 18 election for di state.

Oborevwori bin gada 360,234 votes defeat Ovie Omo-Agege of di All Progressives Congress (APC) wey score 240,229.

Pela chop third position wit 48,027 votes, while Great Ogboru of di All Progressives Grand Alliance (APGA) sidan for fourth position with 11,021 votes.

Pela and im parti come file case for court to challenge di result, sey di candidates wey come first and second no dey qualified, dem chuk hand for corruption and sey dem no folo di Electoral Act.

Advertisement

Dem tell di tribunal sey make dem either annouce Pela as di winner of di election or make dem cancel di election do new one.

WETIN COURT TOK

During the first hearing, Damian Dodo, di main lawyer to di govnor and im deputy, argue sey di LP case bin dey abandoned.

Dodo tok sey di petitioner bin no appear for di seven-day period wey di law tok sey im suppose make case, sey Pela and LP still no come apply for anoda pre-hearing notice, therefore im no get case again.

Advertisement

Di main lawyer to di govnor and im deputy tok sey di pesin wey cari case come apply for pre-hearing notice on May 19 before dem close pleadings, and becos of dat, di case no get head and court suppose no look am.

C.H Ahuchaogu, di chairperson of di tribunal three-member panel, dismiss Pela case for di ruling.

Advertisement

Na so Pela and LP vex sake of di mata, come cari am go court of appeal.

On August 31, di appeal court come finally ansa dem and give order sey make tribunal hear dia case.

Advertisement

FINAL TOK

Di post wey claim sey di tribunal announce Pela as di winner of di Delta governorship election no correct.

Advertisement

Di court only gree sey make tribunal hear dia mata. As of di time wey dis tori comot, dem neva make any decision ontop di case.

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.