Wednesday, May 1, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Di viral quote about Niger coup wey dem sey George Weah tok no correct

Di viral quote about Niger coup wey dem sey George Weah tok no correct
August 10
19:13 2023

One viral quote wey dem put ontop di head of Liberian President George Weah don dey evriwhere for social media.

For one of dis kain posts for Twitter, dem put di quote inside one graphic design way get di foto of di Liberian presido for background.

“Na true sey Liberian President use mouth finish @officialABAT I love dis quote,” na so dem caption di post wey don get more dan 56,000 views since August 3 wen dem share am.

As long as ECOWAS gree for coups wey dey make lifetime presidents, military coups go always dey,” na so di quote wey dem put for Weah head tok.

Advertisement

MILITARY COUP FOR NIGER

On July 26, Abdourahamane Tchiani, leader of di kontri presidential guard, comot President Mohamed Bazoum from office.

Advertisement

A few hours after dem comot Bazoum, Amadou Abdramane, chief informate of di Niger army, announce sey “di defence and security forces don decide end di govment wey una sabi”.

Two days later, Tchiani tok sey im don become president of di National Council for the Safeguard of the Homeland (CNSP), new political party wey di military form.

Advertisement

Niger, kontri wey dey surrounded by land, wey get uranium and gold yapa, bin get im independence on August 3, 1960 from France. Ever since dat time, Niger don cari eye see five different military coups, with di most recent one in July. Di first one bin hapun in 1974, odas hapun in 1996, 1999, and 2010.

Aside from Niger, some oda neighbouring kontris including Mali, Burkina Faso and Guinea, wey bi members of di Economic Community of West African States (ECOWAS), dey under military rule as e bi.

Advertisement

On July 30, President Bola Tinubu, chairman of ECOWAS, togeda wit leaders of oda member states meet for Abuja, Nigeria’s capital. Dem hold di meeting sake of di crisis wey dey hapun for Niger and to see wetin dem fit do about am.

At di end of di meeting, ECOWAS give di military leadership deadline of 7-days to put Bazoum back for office or dem go face critical punishment.

Advertisement

Di African Union (AU) folo give di Niger military 15 days to return di kontri democratic government.

Ontop di ECOWAS deadline mata, Abdramane tok sey: “We wan still remind ECOWAS or any oda pesin wey bodi dey sweet sey we don set our mind to defend our homeland.”

Di quote wey don dey evriwhere wey dem put ontop Weah head, claim sey di former professional footballer, reply di ECOWAS decision for di Niger mata wit: “We no fit condemn military coups wen we no dey condemn di pipu wey dey carry out institutional coups”.

But na true sey Weah tok dose exact words, and where im tok am? Na wetin we find bi dis.

WETIN WE CHECK

Using keyword search, TheCable see sey even as di quote begin dey trend for social media and news platforms in August, most of di posts and tori no tok di time or di place wey Weah make di statement.

Deeper search cari us go one tori by di Sierra Leone Telegraph, wit di headline: “ECOWAS Heads of State suspend Guinea and hold junta responsible for safety of Conde”.

Di tori bin comot on September 10 2021 and get one quote wey resemble di one wey dem put ontop Weah head, during one video conference wey di ECOWAS heads of state attend.

Di discussion for di meeting bin focus on di military coup in Guinea Conakry, wey comot Alpha Conde, wey bi 83 years old at di time of di coup.

During di meeting, Weah tok sey dem send military go Guinea because Conde decide change di constitution make im for achieve im third-term goal.

“As we dey condemn dis military coups, we suppose cari mind look wetin dey cause dis tins wey no dey correct…abi na because we no dey respect di law wey don set time wey we suppose sidan for office as president,” na wetin Weah tell African leaders in 2021, according to di tori.

Although di recent viral quote wey dem put ontop Weah head no bi exactly di same tin wit wetin im tok for di ECOWAS  meeting two years ago, di message no too dey different.

Ledgerhood Rennie, Liberia’s minister of information, tell TheCable sey di recent quote wey don dey evriwhere, ontop George Weah head, “no too straight”.

On July 28, inside one statement, di Liberian govment condemn di “unlawful action wey Niger armed forces dey do”, sey na “insult to di democratic will of di peaceful people of Niger wey bin don already choose dia leaders in a democratic process”.

FINAK TOK

Di claim wey tok sey di Liberian president dey support di Niger coup no straight.

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.