Tuesday, May 14, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Na true sey police arrest Naira Marley and Sam Larry sake of Mohbad?

Na true sey police arrest Naira Marley and Sam Larry sake of Mohbad?
September 20
18:37 2023

E neva tey wey one post for social media claim sey police arrest Naira Marley, di popular musician, and Samson Balogun aka Sam Larry, music promoter, sake of Mohbad as im kpai.

“Dem don arrest Naira Marley and Sam Larry!! Dem go question dem ontop di viral videos wey sey dem abuse Mohbad, di musician wey don die,” na so di post wey @Mrklassiq_ make tok.

As e be so, di post don gada 3.3M views, 30.4K likes and 2,622 reposts ontop X – former Twitter.

Advertisement

Apart from X, di same type of claim comot for Facebook, where dem tok sey police arrest Naira Marley and Sam Larry.

MOHBAD

Advertisement

Mohbad na former musician under Marlian Records, wey Naira Marley get. Mohbad bin kpai on September 12 at di age of 27 and dem bury am di next day. 

Di tins wey make di musician die don dey cause kasala for social media and even among Nigerians wey di tin consign togeda wit music fans.

On October 5 2022, di late singer bin cari mata come X sey Marlian Records “beat” am.

Advertisement

“Just because I wan change my manager wey be dia broda, see wetin dem do me for Marlian House,” na so im bin tweet wit one video  wey show as different marks wit blood dey im bodi.

Im still come ask for help inside di tweet, sey “I dey die inside”.

Some pipu bin tok sey Marlian Records bin make sure sey di singer see pepper  togeda with beating for different times till im die.

Meanwhile, one petition wey Mohbad bin submit to di Force Criminal Investigation Department (FCID) Annex, Alagbon for Lagos on June 27 2023 don comot for internet. Mohbad bin report sey dem bin dey allegedly threaten im life, malicious damage, assault, togeda with oppression from Sam Larry. 

Advertisement

As Sam Larry don deactivate im Instagram account tey tey as plenty pipu attack am afta Mohbad kpai, Naira Marley still dey lose followers for social media as im fans no too dey happy wit am again.

DEM NEVA ARREST NAIRA MARLEY AND SAM LARRY 

Advertisement

TheCable check see sey di police neva arrest either Naira Marley or Sam Larry for questioning sake of Mohbad death.

“Di report no correct; na lie; we neva arrest anybody,” na so Oluniyi Ogundeyi, spokesperson for di Lagos annex of di FCID, tok.

Advertisement

Meanwhile, TheCable bin report sey di Nigerian police don begin investigations into di singer death wey e still neva sure wetin kill am.

On Monday, September 18, 2023, di Lagos state govment set up one 13-man panel to look into di mata and dem conclude sey dem go dig im dead body comot go check for hospital if e dey necessary.

Advertisement

FINAL TOK

Di claim wey sey Naija police don arrest Naira Marley and Sam Larry no correct. Dem still dey investigate di mata and dem neva arrest anybody so far.

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.