MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Viral video wey show as skyscrapers dey collapse no be from Taiwan earthquake

Viral video wey show as skyscrapers dey collapse no be from Taiwan earthquake
April 15
09:54 2024

One viral video wey show as different high-rise buildings dey collapse don dey linked to di Taiwan earthquake.

For di video, you fit see as skyscrapers dey fall, dey raise heavy dust while pipu dey shout wit fear.

Di 13-second video wey den post for X don gada 55,000 views, 30 retweets, 67 likes, and 33 bookmarks.

“Plenti buildings don collapse afta one Pair of Massive 7.5 Earthquakes Strikes, and e cause Tsunami Warnings,” @patrickhsu0906, one X user, caption di video.

Advertisement

Some oda X users wey folo share di video claim sey na from di Taiwan earthquake.

“TAIWAN EARTHQUAKE EPICENTER EAST ASIA❗ Scary scene as Skyscrapers dey collapse for massive earthquake. Di earthquake, wey damage buildings & cause landslides, na di largest wey hit Taiwan in 25 years & dem also feel am for some parts of China, Philippines & Japan.

“Taipei, Taiwan, one 7.4 magnitude earthquake, followed by several strong aftershocks, strike off di east coast of Taiwan on Wednesday morning, killing 9 pipu & injuring at least 963 Pipu, according to Taiwan fire department,” anoda X user, @ZubairSpanish, post.

Advertisement

DI TAIWAN EARTHQUAKE

Advertisement

On Wednesday, one 7.2 magnitude earthquake strike Taiwan, cause plenti building collapse wey kill nine pipu, wound more dan 1,000.

Taiwan Central Weather Administration (CWA) tok sey na movement for di Philippine Sea plate wit di epicenter wey dey extremely shallow, come dey close to land, naim cause di earthquake.

Even doh earthquakes no be new tin for Taiwan, Wednesday earthquake don dey described as di strongest to hit di island in 25 years.

One 7.7 magnitude earthquake bin strike for 1999, causing 2,400 deaths and leaving 100,000 injured, wit thousands of buildings destroyed.

Advertisement

Taiwan na island for di western Pacific Ocean wey dey di line of seismic faults (ring of fire) where most of di world’s earthquakes dey hapun.

WETIN WE CHECK

Advertisement

TheCable check di video for reverse image search and keyframe analysis for InVID, one video verification platform, sey sey e don dey online since August 27, 2021, on The paper Yunan information platform — one Chinese news platform.

According to di platform, dem bin demolish 15 high-rise buildings under controlled supervision for Kunming, Yunnan city of China.

Advertisement

Dem bin demolish di buildings sake of sey dem no meet di basic requirements of modern living and market demands, and sake of sey dem don scatter finish, because of di long time of di unfinished building.

USA TODAY bin upload di video for YouTube on August 31, 2021.

Advertisement

FINAL TOK

Di viral video where skyscrapers dey collapse no be from di Taiwan earthquake but from one controlled demolition for China in 2021.

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.