Monday, April 29, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Video wey get protesters for Emir of Ilorin palace don tey

Video wey get protesters for Emir of Ilorin palace don tey
February 25
12:06 2024

Last week, one video wey show protesters for di Emir of Ilorin palace for Kwara state begin dey waka for social media.

For di video, di protesters, wey be mostly young pipu, dey sing for Yoruba “Ebin palu (hunger dey wipe di city)”.

Sharp sharp, di video enta evriwhere for social media, many pipu come dey tok sey di protest hapun last week sake of di current economic situation of di kontri.

Nigeria don dey experience security wahala, naira dey fall and price of goods dey increase. 

Advertisement

Din tin don cause protests for some parts of di kontri.

On February 5, some residents for Minna, Niger state capital, block major roads for di Kpakungu area to protest di economic hardship for di kontri.

Some days later, residents for Suleja LGA of di state folo protest di high cost of living.

Advertisement

Even on February 10, some market women for Lagos protest di hardship for di kontri. 

Di women bin cari paper wey dem write  “Baba Tinubu, Nigerians dey hungry”, and “Tinubu, come rescue us”, wit some oda tins.

DI PROTEST NEVA TEY?

Afta serious inspection of di video and real foto of di Emir of Ilorin palace, TheCable confam sey di video na for di king house.

Advertisement

But afta plenti search for social media, TheCable still come see sey na only one video of di protest wey dem claim sey neva tey, naim dey internet, which mean sey di tori no too straight. 

One X user wit @omoelerinjare as im name write sey “Breaking News: Serious protest for di Emir Palace for Ilorin Kwara State! ‘Hunger dey catch us. Di state dey Hungry’”.

Di post gada ova 360,000 views and more dan 2,000 shares ontop di social media platform.

Anoda X user @_weyimi write sey: “E do start!!! For di emir of Illorin Palace | we hear as dem tok sey “We dey hungry”. Kontri wey don fall yakata.”

But afta some checks, TheCable see sey different social media users bin share di same video for 2021.

Also, inside anoda statement, Ibrahim Sulu-Gambari, Emir of Ilorin, vex sey pipu tok sey di video neva tey and na sake of di current economic hardship.

“We don notice one video weyy dey circulate for social media wey some pipu dey shout dey lament becos of poverty and hardship for front of di Emir’s Palace for Ilorin,” na so di statement tok.

“We wan tok sey di video na part of di events wey hapun as dem bin wan hold di 2019 general elections.

“Di video no get any connection wit di current situation for kontri, and make una rememba sey di Emir of Ilorin and Chairman, Kwara Traditional Rulers Council, Alhaji Ibrahim Sulu-Gambari, dey always shown im consign to make sure sey peace and harmony go continue to dey di society.”

FINAL TOK

Di video of di protest wey dem tok sey hapun for di Emir of Ilorin’s palace last week don tey wella.



Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.