Sunday, April 28, 2024
MARKET UPDATE
Advertisement Topt

TheCable

Advertisement lead

Yahaya Bello attend di meeting wey Tinubu get with govnors?

Yahaya Bello attend di meeting wey Tinubu get with govnors?
February 21
01:21 2024

Some posts for social media claim sey Yahaya Bello, former govnor of Kogi state, on Thursday, folo attend di emergency meeting wey President Bola Tinubu get wit state govnors.

Di meeting wey hapun for Thursday bin get some key ministers, at di council chambers of di State House, Abuja.

For di meeting, Tinubu and di govnors gree sey more Nigerians suppose join police, to fight di growing insecurity for di kontri.

Afta di meeting, one X (former Twittter) user post one foto wey show as Bello dey tanda wit govnors and Tinubu for di presidential villa.

Advertisement

“Yahaya Bello still dey attend FEC as di govnor of Kogi even afta im hand ova anoda pesin,” na so di tweet tok.

Oda X users also claim sey Bello still dey attend meetings wit di president and sitting govnors even though im hand ova power for January.

Di posts for di claim don gada thousands of likes, retweets, engagements and impressions.

Advertisement

Advertisement

For inside di foto, Bello tanda between Hope Uzodinma, di govnor of Imo, and im colleague from Lagos, Babajide Sanwo-Olu, wit Tinubu for centre, togeda wit oda govnors.

Advertisement

But na true sey Bello attend di meeting?

WETIN WE CHECK

Advertisement

Bello na govnor of Kogi state on di platform of di All Progressives Congress (APC) from 2016 to 2024. Di pesin wey suceed am na Usman Ododo and dem swear am into office on January 27.

As former govnor, Bello no fit represent Kogi for meeting wit Tinubu and govnors; instead, only Ododo or im deputy fit fill dat role.

Advertisement

TheCable check see sey na di presidency post di foto wey don circulate for social media for X. Dem post di foto togeda with message on wetin dem tok for di meeting. 

Anoda check still show sey dem snap di foto for di first meeting wey Tinubu bin get wit state govnors afta dem elect am as president. At dat time, na Bello bin still be govnor of di north-central state.

Advertisement

TheCable still carry di foto check for Google reverse image search, and e show sey e don dey since June 2023.

Also, di clothes wey di leaders wear for di old foto dey different from di ones wey dem wear for inside Thursday meeting.

Di presidency don replace di foto from di old meeting wey dem post for dia X account wit di real ones from di Thursday emergency sit-down.

Ododo bin attend di meeting and im dey inside di fotos.

FINAL TOK

Even though di presidency X handle folo chuk hand for di fake news wey don dey fly upandan, di claim wey tok sey Bello attend meeting wit govnors and Tinubu for di presidential villa on Thursday no correct.

Look di correct foto from di meeting here.

Click on the link below to join TheCable Channel on WhatsApp for your Breaking News, Business Analysis, Politics, Fact Check, Sports and Entertainment News!

Tags

0 Comments

No Comments Yet!

There are no comments at the moment, do you want to add one?

Write a comment

Write a Comment

error: Content is protected from copying.