CHECK AM FOR WAZOBIA

Video wey dem arrest former Gabon senate president don tey

BY Claire Mom

Share

One Facebook video wey show as some officers dey open briefcase wey full wit moni claim sey di former Gabon senate president bin dey try run comot for kontri afta di coup. 

“Breaking News: Dem arrest di former senate president of Gabon wit plenti moni as im dey try escape from im kontri,” na so dem write for di Facebook post.

Di name of di account wey share am na Nigeria News Updates, and e don gada pass 1.5 million views, 3.2k comments and 12k likes.

Advertisement

Di video wey comot evriwhere for different social media platforms like WhatsApp, X, and TikTok show some officers togeda with normal civilians as dem dey try open some briefcases wey full with moni.

Dem write BEAC ontop di bundles of moni, meaning Bank of Central African States.

Advertisement

Dem dey use di BEAC inside six Central African kontris wey be di Economic and Monetary Community of Central Africa. Di kontris na; Cameroon, Gabon, di Central African Republic, Chad, di Republic of the Congo, and Equatorial Guinea.

Di BEAC official currency na Central African franc (CFA).

GABON COUP

Gabon, one of di main kontris for Africa wey dey produce oil, join di Commonwealth in June 2022even as na France bin colonise dem. About 90 percent of di Central African nation dey covered by forest.

Advertisement

On August 30, army officers for Gabon comot President Ali Bongo for office afta im win im third term re-election.

Di coup d’etat for Gabon end di 55 years wey Bongo and im family don sidan for president office.

Di military for Gabon tok sey na Brice Oligui Nguema, one general, be dia leader. Dem put di president wey dem comot for house arrest, come arrest im son for treason.

“We don decide sey we go put peace for front end di current govment,” na so one of di soldiers tok for Gabon 24, one television channel.

During di national broadcast wey show twelve soldiers, di military announced sey dem go cancel di election result wey di opposition tok sey no correct, come add sey dem go cancel “all the institutions of the republic”.

On September 7, eight days after dem comot Bongo for office, di army release am sake of “im health”. Inside statement wey Ulrich Manfoumbi, chief informant of di military, tok for national television, im sey: “If im want, im fit travel go outside kontri for checkup.”

Advertisement

WETIN WE CHECK

TheCable check different keyframes of di video for reverse image search inside Yandex. Di search show sey dem record di video in 2022.

Dem record di old video wen dem arrest Guy Nzouba-Ndama, former senate president and opposition leader, for di kontri border as e dey come back from Congo with currency wey bin reach around two million euros.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey di video dey shows as Gabon former senate president dey try escape from di kontri sake of di coup no correct. Dem record di video one year before di military takeover.

This website uses cookies.